Close Menu
  • Home
  • Latest News
  • Top stories
  • Local News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment
  • More
    • Sports
    • Nollywood
    • Tech
    • Editorial
    • Health
    • World
    • Lifestyle
  • Africa
    • Kenya
    • Nigeria
    • South Africa
Sports

OFFICIAL: Asante Kotoko announce Sanja signing ahead of 2026-27 campaign

August 26, 2026

Black Meteors Learn Road To 2027 U-23 AFCONQualifiers

August 26, 2026

EXCLUSIVE: Ghana FA to appoint local coach for Black Stars job ahead of the AFCON 2027 qualifiers

August 26, 2026
Facebook X (Twitter) Instagram
Ghanamma.comGhanamma.com
  • Home
  • Latest News

    SMT Ghana launches Dongfeng product range at Kumasi open day

    August 26, 2026

    Mahama inaugurates committee to drive GH¢1bn Bawku reconstruction

    August 26, 2026

    Jackfruit’s unlikely rise as Kenya’s next wonder crop

    August 26, 2026

    56.4% of Ghanaians still living in poverty despite economic growth — World Bank

    August 26, 2026

    Nepal flash floods: South Africa, UK and US nationals dey among hundreds of tourists wey dey miss as ova 90 pipo don die

    August 26, 2026
  • Top stories
  • Local News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment
  • More
    • Sports
    • Nollywood
    • Tech
    • Editorial
    • Health
    • World
    • Lifestyle
  • Africa
    • Kenya
    • Nigeria
    • South Africa
Facebook X (Twitter) Instagram Pinterest Vimeo
Subscribe
Ghanamma.comGhanamma.com
Home»South Africa»Nepal flash floods: South Africa, UK and US nationals dey among hundreds of tourists wey dey miss as ova 90 pipo don die
South Africa

Nepal flash floods: South Africa, UK and US nationals dey among hundreds of tourists wey dey miss as ova 90 pipo don die

Ghana NewsBy Ghana NewsAugust 26, 2026No Comments5 Mins Read
Facebook Twitter Pinterest LinkedIn Tumblr Email
Share
Facebook Twitter LinkedIn Pinterest Email Copy Link

Wetin we call dis Video, Aerial footage shows flash flood on Nepal-Tibet border
Article Information

At least 95 pipo don die for Nepal and hundreds of tourists dey missing afta one massive flash flood and mudslide happun for Nepal-Tibet border. Di flash flood bin wash away villages and destroy roads and infrastructure.

Di missing tourists include more dan 100 from India, 47 from US, 3 from UK, 4 from South Africa according to Nepal tourist board.

Di area dey popular wit pilgrims and trekkers.

Nepal Prime Minister Balendra Shah say im dey left wit a “heavy heart” afta di kontri fatal flash floods.

“Di whole nation dey shocked and deeply distressed” by di loss of life and damage to property, e tok for one social media post, as e call di disaster “sudden” and “massive”.

Di flood happun for di early hours of Wednesday for Rasuwa, just north of Nepal capital Kathmandu.

Initial information suggest say na earthquake wey trigger one avalanche wit melted snow wey dey pour into di Bhote Koshi river cause am.

Search operations dey go on for both sides of di border and dem don rescue 88 pipo so far, according to di Nepalese army.

Mud and sand pile up against one hydropower plant wey dey affected by flash flood for northern Nepal

Wia dis foto come from, Shaktimaya Tamang

Wetin we call dis foto, Mud and sand bin pile up against one hydropwer plant

Officials say work dey go on to establish di whereabouts of 579 tourists, wey include 466 foreigners from 28 different countries.

Out of di tourists dem don account for so far, 113 na Nepali, 54 from US, 33 na UK nationals, and 4 from South Africa, according to di police.

Di missing tourists include 12 travellers from the UK plus Americans, Malaysians, South Africans and Indians.

Alpine Eco Trek, wey dey offer guided tours and expeditions for Nepal, confam say 12 British nationals wey dey tour across di Nepal-Tibet border dey miss.

Ram Kumar Adhikari, di manager of Alpine Eco Trek, tok say two Irish nationals and four South African nationals wey also dey on excursion dey among missing persons.

Authorities say 200 out of di pipo wey dey miss na women and 203 na men.

Di foreign nationals come from 26 different countries.

Rescuers use one digger truck to carry an elderly woman to safety. Buildings swamped by mud can be seen in the background

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dem dey rescue survivors

Several areas downstream of di Bhote Koshi river, wey dey flow from Tibet to Nepal, dey on high alert and roads, communications and power for di region also dey affected. Authorities don close di main road to Kathmandu.

Verified videos from Nepal show as water carry one bridge comot and as multi-storey buildings collapse by di force of floodwaters, one town wey also get many buildings destroy.

BBC Verify don locate di clips to di town of Trishuli Bazaar area of Nuwakot District for Bagmati Province, about 25km (16 miles) to di north-west of Kathmandu.

Di video show as di river Trishuli suddenly swell by enormous amounts of water, wey appear to don significantly increase in volume and speed and filled wit sediment.

Di second verified video, wey dem feem from di same location, show di devastating aftermath. Di river leveldon rise well-well, and di water clear trees and many buildings wey dey visible for di earlier video.

One new video wey dem feem from inside one bus for Trishuli show as many pipo dey try run as flash flood rush down di valley.

Pipo fit hear as di passengers dey cry, as di bus drive along di road wey follow di river.

‘Water carry my family members away… for front of my eyes’

Some survivors of di flash flood follow BBC tok.

“Flood sweep my family members away for front of my eyes,” Kalpana Malla from Nepal Nuwakot district tok.

She say di flood clear her father, mother, sister and her sister children were all swept away.

“Dem no fit escape di flood; no chance at all,” she tok. “Dis flood take evritin except my son and I climb di rooftop of a house and survive but I no fit explain how.”

Her son, Sugam Malla, say im pull im mama hand to save her.

Anoda woman, Goma Pandit, tok say she lost her buffaloes and all her oda cattle.

“My farmland don go. Ten sacks of mustard seeds, tons of corn and rice paddy evritin don go. Nothing remain.”

Nepal Army tok-tok pesin Rajarm Basnet tell BBC say efforts dey go on to rescue 115 pipo from di village of Mailung.

Nepalese Ministry of Home Affairs huge loss of life go likely dey for Timure, Syabrubesi and Betrawati. Flooding don also cause damage to di Trishuli hydropwer project.

Di extent of di damage on di Tibetan side ineva dey clear but BBC tok to Guan Daoxuan for Sichuan province wey tok say im lost contact wit im wife on Wednesday morning.

Nepal disaster management authority don ask pipo wey dey live near river banks for vulnerable areas to remain alert and take precautions.

Nepal Foreign Affairs minister Shishir Khanal tell parliament say 26 police personnel, nine armed police officers and 44 members of di military dey miss.

E say one earthquake at 08:37 local time bin trigger one avalanche and preliminary information say na wetin cause di flash flood.

Rasuwa bin see deadly flooding last year wey kill 18 pipo afta one glacier burst on di Chinese side of di border.

Share. Facebook Twitter Pinterest LinkedIn Tumblr Email
Ghana News
  • Website

Related Posts

Essex and former South Africa captain Dean Elgar to retire

August 26, 2026

South Africa reaffirms commitment to stronger BRICS science and technology cooperation – Tech Review Africa

August 26, 2026

Trump shifts all US immigration anti-fraud officers to South Africans after they made up all but 3 refugee admissions

August 26, 2026
Leave A Reply Cancel Reply

You must be logged in to post a comment.

Top Posts

Ghana Power Utility Deploys Infrared Technology to Prevent Grid Failures

August 25, 20260 Views

Seafarer assessment systems must evolve with maritime technology – IMO official

August 24, 20260 Views

Digital tech key to boosting Ghana’s agribusiness  – Experts

July 12, 20260 Views

Ghana Launches Revolutionary E-Visa System to Revolutionize African Travel and Trade Through Digital Innovation

July 11, 20260 Views

Ghana Launches Groundbreaking E-Visa System to Revolutionize African Travel, Trade, and Mobility

July 11, 20261 Views
About Us
About Us

Ghanamma is an independent digital news platform delivering timely updates and reliable information across politics, business, technology, health, entertainment, sports, and world affairs, helping readers stay informed through trustworthy journalism and meaningful insights.

Facebook X (Twitter) Pinterest YouTube WhatsApp
World News

South Sudan’s leader sacks aides after dead man appointed

February 4, 2026

South African white separatists claim land acquired from Zulu king then lost to British

February 2, 2026

Muhoozi’s outbursts expose Uganda’s unease with funding Somalia war

February 2, 2026
Top stories

University of Ghana Attributes Fee Increases to Student Leadership Charges

January 2, 20262 Views

Sam Jonah, 3 Others Cleared Of Criminal Charges In River Park Estate Dispute In Nigeria

January 2, 20263 Views

GCNH donates health logistics to Ho Municipal Health Directorate  

January 2, 20261 Views
  • About Us
  • Contact Us
  • Cookies Policy
  • Privacy Policy
  • Terms & Conditions
  • Disclaimer
© 2026 Ghanamma. Designed by Ghanamma.

Type above and press Enter to search. Press Esc to cancel.