15.2 C
London
Thursday, April 30, 2026

Supreme Court Judgement on ADC: Nigeria highest court to rule on leadership crisis for di country two main opposition parties

Collage of images of the supreme court building and logos of ADC and PDP

Wia dis foto come from, PDP ADC

Read am in 3 mins

Di Supreme Court of Nigeria, dis Thursday go deliver judgement on top two ogbonge cases wey involve di African Democratic Congress (ADC) and di Peoples Democratic Party (PDP), wey be di two main opposition political parties for di kontri.

Di ADC appeal na from di David Mark faction, who dey challenge di judgement of di Court of Appeal wey give order make parties maintain status quo for one internal leadership gbas-gbos for di party.

Na based on dis court of appeal judgement wey di Independent National Electoral Commission (Inec), bin withdraw dia recognition for oga David Mark as di ADC National Chairman and remove im name – plus di name of di National Secretary Rauf Aregbesola – from dia portal.

However, oga Mark insist say leadership wahala for political parties na internal affairs wey, according to Nigeria laws, no be mata for court to determine.

For di oda hand, di PDP case na from Kabiru Turaki, di factional national chairman of di party wey dem elect into office during dia national convention for November last year, but both di high court and di court of appeal don declare dat convention as null and void.

Di court of appeal even go one step further to recognise di rival faction of di PDP wey dey supported by di current Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, as di authentic leadership of di party.

Many pipo for Nigeria dey eagerly wait for dis judgements, especially for di ADC, wey don bicom di leading opposition party in Nigeria afta many political heavyweights in di kontri bin agree to come togeda to form joinbodi movement to try to collect power from di ruling All Progressives Congress (APC).

Former Vice‑President Atiku Abubakar, former govnors Peter Obi, Rabiu Musa Kwankwaso, Rotimi Amaechi, Nasir El-Rufai, Rauf Aregbesola, Liyel Imoke and Aminu Tambuwal – who also na former Speaker of di House of Representatives – na some of di big names for di ADC.

Sabi pipo tok say di Supreme Court judgements go get ogbonge impact for di 2027 general elections wey go hapun for January.

Ahead of di ruling, di David Mark‑led ADC faction bin don write letter to di Chief Justice of Nigeria, as dem dey worry say di party fit dey excluded from di 2027 electoral process if di judgement continue to dey delay.

Meanwhile, di Federal High Court for Abuja, on Wednesday, also give order to ask INEC make dem no recognise or participate for any state congress organised by di ADC caretaker leadership.

Di court also order di party national executive make dem no interfere wit di tenure of elected state executives bicos di conduct of state congresses suppose be di responsibility of state party exco.

Na Justice Joyce Abdulmalik deliver dis judgement, afta some ADC state executives bin carry di mata go court to challenge di authority of di caretaker leadership.

- Advertisement -
Latest news
- Advertisement -
Related news
- Advertisement -