Wia dis foto come from, Kenya Red Cross/Handout via REUTERS
Published
Read am in 2 mins
Six tourists and one pilot don die afta one helicopter crash for Mount Ololokwe for central Kenya, air accident officials confam to BBC.
Di Aircraft Accident Investigation Department tok say dem neva confam di nationalities of di pilot and passengers.
Di Kenya Civil Aviation Authority (KCAA) tok say di accident happun for Samburu County at approximately 09:13 local time (06:13 GMT).
Dem tok say di helicopter bin dey on scenic flight from one wildlife conservancy for Loisaba to Ewaso Nyiro, one river wey dey flow along several national reserves.
One foto wey dey go viral online show smoke for di crash site at Mount Ololokwe.
Di Kenya Red Cross tell BBC say dem no fit access di yet, but dem dey use drones to assess di area.
Di KCAA say di accident involve one Eurocopter EC130 B4 and dem dey coordinate operations.
Di transport ministry and Air Accident Investigations Department go lead “investigations into di circumstances wey surround di accident”, dem add.
Samburu county na popular tourist destination wey get many private wildlife conservancies and e dey popular for dia stunning scenery.
Helicopter crashes dey common for Kenya.
For February, one helicopter crash for di Rift Valley County of Nandi wey kill pipo, plus one member of parliament.
For 2024, di military chief, Gen Francis Omondi Ogolla, die afta one army helicopter wey bin carry 11 pipo crash for di west of di country, wit only two survivors.
For June 2021 at least 10 sojas die wen dia helicopter crash as e dey land near di capital, Nairobi.
