Nigeria identify two ‘new suspected’ cases of Ebola

Nigeria identify two ‘new suspected’ cases of Ebola

Wia dis foto come from, Metin Pala/Anadolu Agency/Getty Images

Nigeria say dem don identify two new suspected cases of Ebola Virus.

According to di Nigeria Center for Disease Control and Prevention (NCDC), dem say dis two new suspected cases na for di Northern region of di kontri.

Dis dey come afta Nigeria evacuate di Ebola patient wey test positive for Abuja back to Switzerland, along wit her husband.

Last week, for statement on dia official website, Swiss authorities say di woman dey receive treatment for Geneva University Hospital, while her husband dey for anoda separate facility.

Di couple wey both of dem na Swiss nationals, dey repatriated from Abuja, Nigeria, on medical evacuation flight on Monday 25 October, 2026.

Meanwhile, dis new suspected cases of Ebola for Nigeria no be confirmed cases until dem do laboratory test.

Di agency say both patients don dey isolated, while dem don begin contact identification and also dey do lab test to establish weda di two don contract di virus.

"Two suspected cases of Ebola disease dey identified for Nigeria North-East region. Both individuals don dey isolated, contact identification and listing dey ongoing, and laboratory testing dey conducted," NCDC tok for dia statement on Saturday 31 October, 2026.

According to NCDC, di classified suspected cases no mean say dem be 'confirmed Ebola cases; confirmation dey subject to laboratory results.'

"Di public dey advised to maintain good hand hygiene, practise enhanced sanitation and follow guidance from public health authorities," di authorities tok.

Dem say dem go provide more details wen more korrect informate dey available.

Dis na afta Nigeria govment don release ₦10bn ($6.7m) in emergency funding to support laboratory testing, purchase protective equipment, mobilise health workers and strengthen oda containment measures, afta di kontri confam one case of Ebola virus.

Ebola na rare but deadly disease wey virus dey cause.

Ebola viruses normally dey infect animals, typically fruit bats, but outbreaks among humans dey sometimes start wen pipo eat or handle infected animals.

E dey take two to 21 days for symptoms to appear. E dey come suddenly and start like flu or malaria, wit fever, headache and tiredness.

Aches and pains for di muscles and joints

As di disease progress, di pesin go start to dey vomit and develop diarrhoea and e fit lead to organ failure. Some, no be all, patients dey develop internal and external bleeding.

Di virus dey spread from one pesin to anoda by contact wit infected bodily fluids like blood or vomit.

Di Ebola outbreak on record na for 2014 for West Africa wit ova 11,000 pipo wey die. Dat epidemic kill five times more dan all oda known Ebola outbreaks wey don happun.

Di current Ebola outbreak for di Democratic Republic of Congo now na di deadliest of di 17 outbreaks di kontri don face and e don continue to spread.

Now, how you fit keep yourself safe and prevent di virus:

– Wash your hands evri time wit soap and water – Health pipo say make we wash hands wit soap and water and clean surfaces wit chlorinated water.

– No dey touch pipo wey don dey infected – To prevent more of di infection, health professionals advise make pipo avoid contact wit pipo wey dey infected, including for dem to stop to shake hands.

E get vaccine for di Zaire strain of Ebola, wey dey common for di past for Democratic Republic of Congo.

And currently no approved vaccine dey for di Sudan strain of Ebola.

Howeva, early treatment of specific symptoms, fit improve survival of di pesin wey get am.

For medical teams, dem must wear full Personal Protective Equipment, PPE, wen dem dey attend to cases to prevent infection. Deadi bodi dem, for any body bag, must dey buried by pipo wey dey wear proper PPE.

Ebola dey quick spread. Small sweat or spit from pesin or animal wey get di disease fit infect pesin.

According to di WHO, new Ebola outbreak go ever dey happun for Dr Congo because di virus dey live for animal reservoir wey dey for many parts of di kontri.

Fruit bats na di main carrier of di disease, but pipo fit dey infected if dem come in close contact wit blood, organs or bodily fluids of animals wey get di virus like chimpanzees, gorillas, monkeys, antelope and porcupines.

Di disease dey very rampant for dis area and e no go dey possible to destroy all di animals wey fit dey carry Ebola.

As long as pipo dey touch and eat dem, possibility dey say Ebola go always return.

📰 Original Source Attribution

Reported by bbc.com.

Read Original Report at bbc.com ↗
Share: WhatsApp WhatsApp
💬

Comments (0)

Join the Conversation

No comments yet. Be the first to share your opinion!

You may like