‘Give Regina space, she don go through a lot’ – Wetin Senator Ned Nwoko write about Regina Daniels health challenge
Senator Ned Nwoko don break silence ova wetin e call 'health challenge' of, Nollywood actress Regina Daniels.
Di Nigerian lawmaker wey dey represent Delta north senatorial district tok say im wife Regina (wey dem no dey togeda at di moment) dey face health challenge wey need support to recova.
Nwoko say Regina need space and make anybody no judge her as she dey go through a lot.
Dis na in reation to one video wey Regina Daniels bin post on her birthday wey show wia she dey siddown for wheelchair dey share tori of wetin she dey go through and how she dey survive.
Di video cause different debate for social media about di current health state of di Nollywood actress.
For im post for Instagram on Monday 2 November, 2026, Ned Nwoko say make pipo leave Regina alone, make dem no drag her inside fake tori wey some pipo dey spread.
Dis matta don dey trend for social media, as some dey look how Ned write di long epistle for di mother of im pikin (even though dem no dey togeda again).
'My eyes see plenti tins during election campaign' – Regina Daniels Nwoko18th September 2023'Six years later, she still no fit resist me!' – Regina Daniels husband poem to her totori pipo27th March 2025End of content
Rememba say for October 2025, New Nwoko say im no dey abusive instead na im wife dey addicted to hard drugs and alcohol, claim wey Regina no respond to.
Dat na afta one kwanta happun between di two lovers wia Oga Nwoko for social media post allege say im wife dey battle drugs and alcohol abuse and e wan make she kontinu her rehabilitation program ova fear for her life and safety.
Na around dat time Regina Daniels allegedly comot for Ned house.
Di 65-year-old senator, tok dat time say im no dey violent towards any of im wife but she move comot from house becos she wan get unrestricted access.
"Regina no always like dis. Her current battle wit drugs and alcohol abuse na di root of our problem. Now she don move to place wia she get unrestricted access to drugs. I get oda wives, and none go ever accuse me of violence," Ned tok dat time.
Senator Ned Nwoko for im new writeup, e say make friends, fans and bloggers give 'Regina some breathing space'.
For inside di write-up, oga Ned say e dey make di appeal sake of her pikin wey go like see say dia mama dey receive betta support and love.
"Regina don go through a lot, more dan many pipo fit realise, and right now, wetin she need most na love, support and di opportunity to recova."
"Di video she share on her birthday give pipo glimpse of some of di health challenges wey she don dey deal wit," Ned write.
Di Senator say im sabi Regina well well and e sabi wetin she don go through. E add say dis no be di time to 'judge or add to her burden, but na time to show love and allow her heal'.
"Regardless of di difficulties we don face,her well-being dey always matter to me. Na di veri concern wey bring much of our private situation into di public domain," Ned say.
Oga Ned say im dey concerned about di circulation of false reports wey include 'death announcements' and oda painful contents.
E say regina dey see some of dose social media posts and e dey give her more stress. And dat kain content no dey support her recovery, but e dey add to di burden.
"Make I make dis veri clear: I no go tolerate di deliberate spread of false information about Regina, particularly fabricated reports about her death, health or personal circumstances."
"Regina deserve di opportunity to recova without subject to fresh wave of fabricated stories evriday, Ned say.
Oga Ned say anybody wey dem catch wey dey spread di fake tori go dey accountable to am if dem catch di pesin.
Regina Daniels na popular actress for di Nollywood industry.
Regina start her career as child actress at di age of 7. She feature in her first movie for 2007 in di movie "Marriage in Sorrow".
Since den she don feature in ova 100 Nigerian movies including Miracle Child, Python Girl, Spider-Girl, Hanging Coffin, Jaja the Great, Queen Rebecca, among odas.
Regina Daniels marry Ned Nwoko at di age of 18. Dia marriage don reach six years and dem both get two pikin.
Regina na di youngest wife of Ned, and she dey popular as an actress in di Nigeria feem industry. Dem don nominate her for plenti awards and she don win some too.
Regina get five siblings, wey dey supportive of her career and she be Mass Communication graduate and recently she join di Senators Wives Association as dia social secretary.
Wia dis foto come from, PrinceNedNwoko/Instagram
Nwoko na Nigerian politician, lawyer and philanthropist.
Ned Nwoko go University of Keele, Staffordshire, wia e bin get im first and second degree in law.
Afta e finish school for UK, dem call am to English Bar for Lincoln Inn, one of di four Inns of Court for London.
Ned Nwoko start im career as lawyer for United Kingdom, wia e gada experience bifor e come back Naija to do politics and business.
For 1995, dem recognise am as di Best Black Lawyer of African Descent for England, for im success in di England legal field.
After e make am well for im legal career for United Kingdom, Nwoko return back to Nigeria for 1998.
E enta politics for 1999 and serve as House of Representatives member, e represent Aniocha/Oshimili Federal Constituency of Delta State from (1999–2003)
Ned na still active politician and e be sitting senator wey dey represent Delta North Senatorial District.
Comments (0)
No comments yet. Be the first to share your opinion!