Donald Trump don issue several executive orders on everything from immigration, climate to pardons after e dey sworn in as di 47th president of United States.
For di White House, di Republican quickly begin use im new powers to sign off executive actions, presidential memorandums and executive orders ontop some policy priorities.
Executive orders carry di weight of law, but e fit dey overturned by presidents after or courts. Many fit face legal challenges.
Dis na some of di many policy changes wey Trump sign within hours after e dey sworn into office.
Immigration
National emergency for di border
For di Oval Office, Trump sign a directive to declare a national emergency for di southern border. “Dat na big one,” Trump tok as e add im signature.
E also target automatic citizenship for US-born children of immigrants for di country illegally.
Trump also sign order wey dey set to suspend US refugee resettlement programme for four months, though di details no too clear.
Closing di border
Trump ordere di military to “seal di borders” and cite di flow of illicit drugs, human smuggling and crime relating to crossings.
Terrorism designation for gangs and cartels
Di president sign directive wey name drug cartels and international gangs as foreign terrorist organisations. Salvadoran migrant gang MS-13 and Venezuelan gang Tren de Aragua go dey added to a list wey include al-Qaeda, the so-called Islamic State and Hamas.
Resume wall-building
As part of im emergency declaration for di southern border, Trump direct agency chiefs to relaunch efforts to “construct additional physical barriers along di southern border”. Dis directive no be executive order and e no dey clear how such effort go dey funded, na key hurdle for Trump during im first term.
Wen Trump bin first dey elected president for 2016, e sign one executive order to build a border wall. Although dem build some parts of barrier, dem leave most uncompleted.
‘Remain in Mexico’
Trump also re-implement im “Remain in Mexico” policy in a day-one executive order. Measure from im first term, e return about 70,000 non-Mexican asylum seekers across di border to wait hearings.
Migration policy
For di same order, Trump also shut down one major Biden-era immigration pipeline: wey be sponsorship initiative wey allow up to 30,000 migrants from Cuba, Haiti, Nicaragua and Venezuela to fly to US.
Dis policy, wey dey known as CHNV, bin dey designed to lower illegal border crossings, Biden administration bin tok.
Death penalty for certain immigrant criminals
Trump sign executive order wey bring back death penalty. Di order include pipo wey di penalty go dey used on and include any “capital crime wey dey committed by an alien illegally present in dis country” and anyone wey dey convicted of murdering a law-enforcement officer.
Deportations
Trump issue executive order ending di practice of “catch and release”, policy wey allow migrants to live for US communities while dem dey wait their hearings.
E don promise before to “launch di largest deportation program in American history” and end a long-time policy wey don keep federal immigration authorities from conducting raids on churches and schools.
Im immigration promise dem fit face legal and logistical challenges.
TikTok
Trump also sign directive wey postpone di implementation of a law banning Chinese-owned social media platform TikTok for 75 days.
Trump bin say im order go give TikTok parent company more time to find a US partner to buy a majority stake, but details on di directive wey e sign no clear.
Wen dem ask am wetin e mean after e sign am, Trump say e give am di right to “sell it or close it”.
Government reform
Doge and Elon Musk
Trump don sign a directive wey create the Department of Government Efficiency (Doge) – new advisory body wey dey aim to cut government costs. E dey expected say na Elon Musk go lead am.
Trump say Musk, wey be di head of Tesla and SpaceX, go get office for about 20 employees for di new agency.
Freeze on federal hiring
Trump sign action wey stop any new federal hiring – except within di US military and several other categories – until di Trump administration get full control over di government.
Federal employees returning to the office
Trump sign document mandating say federal workers must work in di office and dem no dey allowed to work from home.
Censorship
Trump sign directive “ordering di restoration of freedom of speech and preventing government censorship”.
Di order direct di attorney general to investigate di activities of officials for such agencies as di Department of Justice, di Securities and Exchange Commission, and di Federal Trade Commission during di previous administration.
Political prosecutions
Di new US president sign executive order wey seek to end di “weaponization of government against political adversaries”. Di order mandate a review of di work of various law enforcement and intelligence agencies under Biden administration to “identify any instance” of weaponisation, and den recommend “appropriate remedial actions” against dis agencies.
World Health Organization
Trump sign executive order to begin di process of withdrawing di US from di World Health Organization (WHO).
E mark di second time Trump don order say make US pull out of WHO.
Trump criticise how di Geneva-based institution handle Covid-19 and begin di process of pulling out from am during di pandemic. President Joe Biden later reverse dat decision.
Reversing Biden policies
America First
Inside executive order, Trump pause foreign aid and outline say e wanted a review of foreign assistance programs. Karoline Leavitt, White House press secretary, say dis na part of a new “American-First” foreign policy.
Cuba
Trump issue a directive to cancel Biden recent decision to remove Cuba from di US list of state sponsors of terrorism. E fit also reinstate sanctions against Venezuela. Both countries be im frequent targets during im first administration.
Biden-era regulations
One of di first directives Trump sign as part of im second term na document wey cancel nearly 80 Biden-era regulations.
Regulatory freeze
Trump sign directive wey freeze any federal agency from issuing any new regulations until di Trump administration get full control of di government.
Unvaccinated federal workers
As part of a directive reversing Biden-era policies, Trump revoke mandate wey say federal workers must dey vaccinated with di Covid vaccine. E don promise to bring back di 8,000 military service members wey dem discharge due to Pentagon Covid vaccine mandate – with full backpay.
Diversity and gender
Transgender people
Trump issue executive order declaring say US go only recognise “two sexes, male and female. Dis sexes no dey changeable and dey grounded in fundamental and incontrovertible reality.”
Di order go affect transgender policy regarding government communications, civil rights protections and federal funding, as well as prisons. E go affect official documents like passports and visas.
DEI
In di same executive order, Trump end all government programmes, policies, statements and communications wey dey promote or support “gender ideology”.
In a separate executive order, e stop all “diversity, equity and inclusion” (DEI) programmes within di federal government. Di order dey called “ending radical and wasteful government DEI programs and preferencing”. Di order cover all federal agencies and include those wey get federal grants, or get federal contracts.
Di incoming administration don also promise further actions wey fit affect di private sector.
Renaming the Gulf of Mexico
‘Gulf of America’
Among Trump first executive orders na one wey direct di secretary of di interior to change di name of the Gulf of Mexico to the “Gulf of America”.
Alaska Mount Denali
Di same order also direct di interior secretary to rename Alaska Mount Denali to Mount McKinley – in honour of America 25th president wey Trump admire im tariff policies. President Barack Obama change di name from McKinley to Denali to reflect wetin di native tribes dey call am. Na di highest mountain peak for North America.
Economy
Tackling inflation
E sign directive asking every US federal department and agency to address di cost of living for Americans. Di directive, wey no be executive order, ask agencies to look at lowering di costs of housing, healthcare and key household items, groceries and fuel.
E ask for a report in 30 days. E no clear how di Trump administration intend to lower dis costs, and e no dey laid down for di directive.
Climate and energy
Pull out of the Paris agreement (again)
As part of di first batch of directives, Trump sign off on withdrawing from di Paris climate agreement – di landmark international deal wey dey designed to limit rising global temperatures.
Na among di first documents Trump sign after im inauguration.
Trump first withdraw from di Paris accord for 2017, before Biden re-enter am in 2021.
Along with signing off on exiting di deal, Trump also sign a letter wey dem go send to United Nations explaining di withdrawal.
National energy emergency
Trump declare a national energy emergency, promising to fill up strategic oil reserves.
E sign executive order titled “unleashing Alaska extraordinary resource potential”, wey deal with oil and gas and oda natural resources.
Di new president also vow to “drill, baby, drill” for more American fossil fuels.
End Green New Deal
As part of di executive order on energy, Trump stop di so-called green new deal, a series of Biden administration measures wey bin dey aimed at boosting green jobs, regulating di fossil fuel industry and limiting pollution.
Trump order agencies to stop funds dem dey give through two laws, the Inflation Reduction Act and another law on infrastructure and jobs.
E also say di US go end leasing to wind farms and revoke wetin e call an electric vehicle “mandate”.
Capitol riot
Pardoning nearly 1,600 people wey storm US Capitol
Trump announce say e dey issue pardons for nearly 1,600 of im supporters wey dem arrest for di riot for di US Capitol for 2021.
Trump don again and again refer to those dem arrest for di riot as “hostages”. At least 600 bin dey charged with assaulting or preventing federal officers.
Commuting sentences of Oath Keepers, Proud Boys
Trump also commute di sentences for members of the Oath Keepers and Proud Boys, far-right groups, wey bin dey convicted of seditious conspiracy in relation to di Capitol riot.
Lawyer for former Proud Boys leader Henry “Enrique” Tarrio, wey dem jail for 22 years for seditious conspiracy over di riot, say im client also expect to dey released.
Wetin Trump never act on – yet
Tariffs
After dem don dey ready for weeks for a trade war with US, Canada – for now – don dodge tariffs wey Donald Trump bin threaten to impose on di country as soon as e take office.
But Trump tok on Monday say di tariffs on Canada and Mexico fit come on 1 February and order federal officials to review US trade relationships for unfair practices, including those with Canada, Mexico and China.
Trump pledge import duties of 25% on Canada and Mexico, as well as 10% on global imports and 60% on Chinese goods.
Secret documents
For one rally on Sunday, Trump say e go release classified documents related to di assassination of President John F Kennedy for 1963, na a subject of countless conspiracy theories, as well as di 1968 killings of Senator Robert Kennedy and civil rights leader Martin Luther King Jr.
Crypto pile
Trump don champion cryptocurrency, and im election see di value of Bitcoin increase by 30%.
Some believe say Trump go move quickly to create a federal “Bitcoin stockpile” – a strategic reserve similar to US stockpile of gold and oil – wey e say go serve as a “permanent national asset to benefit all Americans”.
