Di special prosecutor for Ghana don warn say im dey expect di former finance minister of di kontri, Ken Ofori-Atta to appear bifor im office to answer questions about plenty corruption matters, on 2 June, odawise, im go take serious action.
Oga Kissi Agyebeng for February dis year declare di former finance minister under di Nana Akufo-Addo goment, wanted for corruption for di role im play for multiple goment contracts from 2017 to 2024.
For one press conference, di prosecutor tok say, “we don declare Kenneth Nana Yaw Ofori-Atta di former minister as fugitive ova some contracts like di PDS contract for di kontri electricity company, di procurement of contractors and materials and oda payment for di national cathedral project, contract by di ministry of health for 307 Mercedes Benz ambulances and contract by di Ghana revenue authority to SML for transaction audit.”
Di prosecutor at di time tok say dem bin write to di ex-finance minister say make im appear on 10 February 2025, but im no come.
Na so im lawyers tok on 31 January 2025 say im dey “out of di kontri indefinitely on medical grounds wia dem neva sabi when im go dey fit to dey available to meet di prosecutor.”
Di prosecutor also bin reject one medical letter wey lawyers for di ex-finance minister don send to im office.
But afta lawyers for di former minister bin properly write to di prosecutor to tok when dia client go get greenlight from im doctors to appear.
Na so di prosecutor Kissi Agyebeng don remove Ken Ofori-Atta from di wanted list ova corruption investigations.
Im give am 2 June, 2025 to appear bifor di office of di special prosecutor physically to answer di questions.
But Kissi warn say im no go hesitate to carry di ex-finance minister enta di wanted list again, if im no show up on 2 June.
“Di OSP go carry all legal steps to ensure say im return to di kontri and face di prosecutors,” oga Kissi Agyebeng add.
For di last statement wia di special prosecutor release on top dis mata, im tok say “oga Ken Ofori-Atta gatz to appear in person bifor di office of di prosecutor on 2 June. If im fail to show up, we go consider am fugitive against justice.”
“Di OSP go put am on top INTERPOL red alert notice wia we go take steps to extradite am from wherever im go dey.”
Di former finance minister wan meet di prosecutor virtually?
For March dis year, di ex-finance minister bin file law suit against di office of di special prosecutor wey im dey ask for compensation for wetin im describe as “unlawful declaration as wanted”.
Im also don dey ask di court to cause di office of di prosecutor to remove all di oda content about im wanted declaration from dia social media platforms.
On 28 March, di human rights court don hear di interim application from di ex -finance minister.
But fresh tori wey don comot bifor 2 June na say di ex-finance minister still no go dey available to meet di prosecutor.
Local media don dey report say lawyers for di ex-finance minister don file medical reports for di 66-year-old as part of dia case for di human rights court.
“Im lawyers bin formally tok di latest development about im health to di office of special prosecutor and di court, wey dem also tok di various medical procedures im gatz to undergo,” citinewsroom don report.
Di ex-finance minister im camp don tok say im “offer to participate for di special prosecutor im investigations virtually, sake of im still no dey well,” citinewsroom add.
One of di lawyers for di ex-finance minister, oga Frank Davies don tok say im dey surprised how di public no dey believe say Ken Ofori-Atta dey sick, wia im dey undergo treatment for di US.
“If I tok say i go come see you tomorrow wia I bin suffer casualty di night bifor, you go still see me? why dis tin dey difficult for pipo to understand say di pesin wia dey involve for dis mata dey sick?,” oga Davies tok local network Joy FM.
“Im health mata dey known even bifor dem begin to prepare di charges against am, who for dis kontri no sabi say Ken Ofori-Atta bin dey sick?”
Di office of di prosecutor no publicly respond to dis request yet.
Di human rights court also go make dia ruling on dia suit against di tag di prosecutor take describe am say im be wanted, on 18 June.
Sabi pipo don tok say make di special prosecutor go ahead and charge di ex-finance minister and carry am go court even tho im no dey present for di kontri.
Dem don tok say dem go fit to “try di former minister in absentia”, but as to whether di OSP go take dis step, na time go tell.
Ghana bin dey under $3bn IMF programme, to deal with di kontri economic crisis.
During di tenure of di ex-finance minister, sabi pipo and di opposition party tok say im supervise di crisis.
Eighty lawmakers for im own party, di goment NPP for 2022 write petition to di president at di time, Nana Akufo-Addo, say make im sack di finance minister Ken Ofori-Atta, wey be di president cousin from office, otherwise dem no go be part of goment business for parliament.
For one press conference, di MPs tok say “di economy don spoil, na so if you no sack dis minister, we no go dey parliament wen di goment dey present di budget,” leader of di caucus Andy Appiah Kubi tell journalists.
But di president at di time tok say im no go sack di minister, unless im finish dey negotiate di IMF deal for di kontri.
