One chieftaincy conflict bin dey go on for one part of Ghana for more dan 60 years.
Di ‘Bawku conflict’ na between two ethnic groups for di Upper East region of di kontri and according to sabi pipo di fight na sake of who go rule di pipo on top di land.
Ova di years, tension don dey di area wia fight don dey happun every time.
E bin lead to death of many pipo wey dem destroy properties.
Govment afta govment don struggle to deal wit di conflict.
Di small arms commission and oda groups raise alarm about weapons wey bin dey move around for dat part of di kontri as di conflict dey continue.
One lawmaker wey be ex-senior police officer Peter Toobu tok for local radio network Joy FM for April 2025 say tins don dey get out of hand.
“Di flow of weapons for Bawku na real tin, di proliferation of small arms and light weapons for dis kontri na big matter.”
Im add say “e dey possible say pipo wey bin dey trade in arms for dia go dey make plenty money.”
Im also fear say oda pipo don dey “radicalise di youth” for Bawku to continue di conflict.
Recently, di youth for di area don attack security personnel – dem also kill some of dem, sometin oga Peter Toobu, di retired police office dey worried about.
Q: Wetin happun over di weekend
Ova di weekend, gunmen don allegedly storm senior high school campus for Bawku and Nalerigu wia dem open fire.
Dem bin kill two male students for di Nalerigu senior high school Saturday evening.
Assembly member for di Denugi electoral area confam di tori, according to state news outlet daily graphic.
Anoda kasala happun for di Bawku senior high school dat same Saturday night wey dem allegedly kill one student for dia.
Dem don also allegedly set di house of di member of parliament for Bawku, Mahama Ayariga on fire.
Dis no be di first di house of di MP bin dey under attack for di last few months.
Q: Why dem shutdown schools wey dem evacuate students
Di municipal education office shut down di Bawku senior high school indefinitely afta di death of di student.
Director for di education office oga Isaac Agbeko announce di closure of di school “sake of safety concerns for both students and teachers.”
Inside one statement from di govment communication minister, dem tok say dem dey “evacuate students from di Nalerigu and Bawku senior high schools” afta di tension bin rise.
“As part of govment effort to enforce peace for dia, we bin dey evacuate all students from various educational institutions for di affected areas, some of wey bin dey targeted for di conflict,” Felix Kwakye Ofosu, di govment tok tok pesin write inside di statement.
Q: Why dem renew curfew for Bawku, Nalerigu and dia environs
Di latest tension don force di interior ministry to revise di curfew time for those areas.
Inside one statement di interior minister Muntaka Mohammed tok say “wit di advice of di North East regional security council and by executive instrument, we don impose curfew hours for Nalerigu and di oda townships from 2 PM to 6 AM effective Sunday 27 July, 2025.”
“Dis na until further notice; govment bin dey call on di chiefs, elders, di youth and pipo for dia to exercise restraint for dis tough time and use non-violent means to ensure peace.”
Di ministry also tok say “we don ban all pipo for Nalerigu and di oda communities from carrying arms, ammunition and any oda offensive weapon.”
“Any pesin we go find wit arms and ammunition go dey arrested and prosecuted.”
Dem ban motorbikes afta dem kill one local Kusaase chief for Asawase for Ashanti region
Q: Why dem ban motorbikes, smock and oda clothes for Kumasi
Bifor di weekend killings for Nalerigu and Bawku, dem bin kill two pipo for di Ashanti region; of dem na local chief of Kusaase – Alhaji Abdul-Malik Azengbe.
Police begin investigation for di matter but sabi pipo tink say dey connected to di same Bawku conflict sake of one of di feuding parties bin dey involved.
Afta di death of di local chief di Ashanti regional security council don take some measures
– no motorbikes go dey allowed on top di road between 7PM and 6AM until further notice
– motorbike riders no dey allowed to carry passengers or additional pesin during di day
– di use of unregistered motorbikes dey banned
– di inter-tribal football competition wey bin dey go on for di area dey suspended wit immediate effect
– no motorbike rider dey permitted to wear smock, jacket or three-piece suits as pipo bin dey use dem to hide weapons
– pipo no dey allowed to carry weapons whether dem dey licensed or not inside dia cars or on top motorbikes
– dem increase police and soldiers for hotspot areas for di region
– di security go do random stop-and-search for checkpoints
Q: Wetin govment do to beef up security for Bawku, Nalerigu
Govment step up peace enforcement for Bawku and oda affected areas due to di “escalation of violence wey bin dey affect peace-building efforts by di govment.”
Inside di statement govment say “di armed forces don deploy soldiers to maintain law and order as we intensify curfews to ensure public safety.”
“We bin dey assure di public say di Ghana armed forces go take all necessary strips to protect lives and property,” di govment tok tok pesin add.
Dis no be di first time govment bin dey deploy soldiers to Bawku for dis chieftaincy conflict.
But dem dey hope say dis latest deployment go help di situation.
Q: Wetin be di status of mediation to bring peace dia
Di latest kasala bin dey affect mediation efforts.
Di govment don select di Ashanti king say make im lead mediation efforts for di conflict.
For 2 July 2025 di King Otumfuo Osei Tutu II resume mediation wia im hold close-door meeting wit leaders of di factions.
Dis bin follow meetings im do separately wit representatives of di two factions for 29 April 2025.
Govment bin dey commend di Ashanti king Otumfuo Osei Tutu II and di stakeholders wey bin dey involved for dis mediation.
“Di Otumfuo mediation wit di help if Nayiri (overlord of Mamprugu kingdom) and Zugraana (paramount chief of di Kusaug traditional area for Bawku), don almost solve di conflict bifor di latest killings wey don call for ogbonge action to protect everybody.”
Di conflict for Bawku don affect many tins – education, health, business and odas.
Di inspector general of police Christian Tetteh Yohuno don visit di area recently afta dem appoint am as new IGP.
Im appeal to di youth for dia to “lay down dia arms”, but tension still dey di communities.
Q: Wetin President Mahama tok about di kasala
President John Mahama say govment dey committed to “restore lasting peace and stability for Bawku.”
“We believe say peace for Bawku na national matter wey bin dey require everybody so say justice go prevail make we solve dis issue wit dialogue.”
Di president tok dis on 20 July 2025 when delegation of pipo from di Mamprugu chief bin pay courtesy call for di presidency.
Im tok say di Bawku conflict bin dey affect everybody for di area including all di ethic groups dia.
Public sector workers like teachers, nurses, among odas don run comot di area sake of di tension wey odas neva dey want posting to di area sake of di tension.
“Nobody dey happy about dis situation for Bawku but we go do our best to address di matter.”
Dem bin allegedly kill three students for two secondary schools for di latest tension for Bawku and Nalerigu

Di interior ministry don ban movement of arms and ammunition for Bawku and Nalerigu wey dem renew di curfew from 2 PM to 6 AM everi day
