Transgender women no go fit play women football again for England from 1 June, na wetin di Football Association announce.
Dem amend di rules on 11 April, as dem apply strict eligibility criteria for transgender women to kontinu to play for women football for all levels.
However, sake of di ruling wey di Supreme Court for UK give on 15 April di legal definition of a woman now dey based on biological sex.
Di FA now don scrap di policy and say only di pipo wey dem born biologically as female go dey permitted to play.
“Dis subject dey complex , and our position don always be say if a material change for law, science, or di operation of di policy dey for grassroots football den we go review am and change am if necessary,” di FA tok.
“We understand say dis go dey difficult for pipo wey just wan play di game and dem love di gender wey dem dey identify wit.
We don already start to contact di registered transgender women wey dey currently play to explain di changes and how dem fit kontin to stay involved in di game.”
Di FA tok on Thursday say di transgender women wey dey registered no reach 30 among millions of amateur players.
No registered transgender women dey for di professional game across di Home Nations.
However, di Scottish FA don ready to follow di FA ruling, dem wan also ban transgender women from women football for Scotland.
Sources don tell BBC Sport say dem dem also expect di England and Wales Cricket Board (ECB) to ban transgender women from di women game.
Di ECB bin don dey take legal advice on dia transgender policy sake of di Supreme Court ruling and dem dey expect di board to sanction changes for dia transgender policy for di board meeting on Friday.
On Thursday England Netball also change dia guidelines as dem also ban transgender women from dia female category.
Wetin be di former FA policy?
Under di amended rules wey dem announce on 11 April, di FA say transgender women fit kontinu to participate for women football if dem meet certain condition.
Dem get to prove thru medical records say dia testosterone levels dey below prescribed levels for at least di past 12 months, and provide a record of hormone therapy and an annual review of treatment.
A new formal process, wey go involve “match observation” by FA official, go give di FA “ultimate discretion” on a case-by-case basis.
How pipo dey react to dis announcement
Fiona McAnena, director of campaigns for human rights charity Sex Matters, say di ruling dey “overdue” and say di previous policy dey “nonsensical”.
Former Olympic swimmer Sharron Davies, wey dey also tok about di issue of transgender women for women sport, tok on X: “Dis na great news for di safety and fairness of all our girls and women in football. Dem bin no suppose allow am in di first place. Now evri sport must follow suit.”
Campaign group Women’s Rights Network say: “We dey happy say di FA don finally seen di light. But e no suppose fight so hard to get here.”
Wen dem ask Prime Minister Sir Keir Starmer wetin im bin tink about transgender women ban from women sport, im tok-tok pesin say di goment always “dey clear say biology dey important wen e come to women’s sport and say make evribody dey compliant wit di law”.
Im say di goment go “kontinu to work to make sure say women and girls across di kontri fit enjoy sports and we go continue to support bodies to protect di integrity, safety and fairness of di game”.
Im say na di responsibility of sporting bodies to set dia own rules.
Natalie Washington, campaign lead for Football vs Transphobia, say transgender women dey likely to give up football now.
“Di pipo I know wey dey tok about dis dey tok say, ‘Well, e don end for football for me’,” she tok.
“Most pipo clearly no feel say dem fit go play for di men’s game for reasons of safety, for reasons of comfort.”
Lord David Triesman, former chairman of di FA, say “consequences for di most senior FA officers” wey bin take di decision to allow transgender women play women’s football suppose dey.
“Di FA don finally see sense. E for be di highest foolishness to disregard di Supreme Court,” im tok.
Anti-discrimination group Kick it Out say: “Now na di time to show solidarity wit di trans community and remind oursefs say football dey bring pipo togeda and na a space for belonging, connection, and joy evritime.
“Di recent Supreme Court ruling and di FA decision to change dia policy go get far-reaching consequences, not only for di pipo we dey support but for our friends, families, team-mates and wider communities.
“Transphobic abuse – on di pitch, for di stands and online – dey real and e dey rise.”
What about other sports?
Di FA na di first major governing sporting body to amend dia transgender eligibility criteria sake of di Supreme Court ruling.
Di Ultimate Pool Group (UPG) – di professional body for eight-ball pool – bin ban transgender women from dia female category last month.
Oda governing bodies, including di World Professional Billiards and Snooker Association (WPBSA), dey reassess dia transgender eligibility criteria.
Athletics, cycling and aquatics don implement outright bans on transgender women wey dey participate for women’s events.
For 2022 British Triathlon becom di first British sporting body to establish an open category wia transgender athletes fit compete.
Dis year di ECB bin ban transgender women from elite domestic cricket.
Di ruling mean say any player wey bin don go thru male puberty no go fit feature for di top two tiers of di women’s game, but say transgender women still dey eligible fto play from di third tier and below.
However, di ECB dey expected to follow di FA ruling by banning transgender women from all levels of di women’s game.
England Netball new guidelines, wey go apply from 1 September, recognise three distinct gender participation categories: female, male and mixed.
Di female category go be “exclusively for players born female, irrespective of dia gender identity”, while mixed netball go “serve as di sport inclusive category, wey go allow players to complete under di gender wey dem dey identify wit”.
‘FA bin no get choice’ – analysis
BBC sports editor Dan Roan
Di FA don begin do tok-tok wit di 28 transgender women wey dey registered for England wey di policy change go affect as dem dey try to find ways wey dem fit still dey involved for di sport.
In recent years, governing bodies of oda sports, like rugby and hockey, bin introduce tough gender policies, wey add to di pressure on football to follow suit.
Senior officials insist say dem neva take any ideological position on wetin dem dey see as a complicated issue, and dia task na to always provide as many opportunities to play to as many pipo as possible.
But di fact say dem need to do U-turn on di transgender eligibility policy wey dem bin update only three weeks ago no go dey too good.
Di FA reject suggestions say dem bow to pressure, wit di claim say dem bin no get any choice to amend dia approach yet again becos dia lawyers bin conclude ay di subsequent Supreme Court ruling last month bin make dem vulnerable to potential legal claims from some biologically female players.
But di fact say dem don follow suit go dey welcomed by di pipo wey bin feel say dia previous stance na unsatisfactory attempt to compromise between competing rights and freedoms – one wey di critics bin feel say no get clear direction, wey create unclear and impractical guidelines and e potentially compromise di fairness on female players and safety as a result.
Supporters of di trans community no go dey happy sake of wetin dem see as an unnecessary, exclusionary and discriminatory policy wey dey risk further marginalisation of a small number of pipo from di sport wey dem love.
