13.9 C
London
Friday, October 17, 2025

Ghana govment slap two ex-National Service officers wit $54m stealing, money laundering and financial loss charges

Di two ex-directors dey accused of using dia office for profit and private gain Di two ex-directors dey accused of using dia office for profit and private gain

Di attorney general of Ghana don formally charge two former directors of di National Service Authority (NSA) in one corruption and ghost names scandal.

Di two – Osei Assibey Antwi (director) and Gifty Oware-Mensah (deputy) dey face multiple charges wey cause financial loss to di state to di tune of GHC 640m ($54m), according to court documents.

Inside two court documents wey di state file for di High Court for Accra, di state dey accuse di former director and im deputy say, “dem create two schemes wey siphon public funds through ghost service personnel and fraudulent bank loans.”

For June dis year, di attorney general announce during one press conference say dem dey wrap up investigation into various corruption cases wey involve former govment appointees.

Dis be di latest in di govment Operation Recover All Loot (Oral) agenda wey dey target to collect all di moni and properties wey former govment appointees allegedly steal.

Osei Assibey Antwi dey face 14 counts of stealing, money laundering and oda charges

Di former executive director Osei Assibey Antwi dey face charges wey include – causing financial loss to di state.

According to di state, Osei Assibey Antwi during im time as director for di NSA, authorize payment of allowances to more dan 60,000 non-existent national service personnel (ghosts), wey lead to di loss of GH¢500m ($42m).

E dey face plenty counts of stealing amounting to GHC8.3m ($686k) between August 2023 and May 2024.

Di state dey also accuse Osei Assibey Antwi say e misuse funds by authorizing withdrawal of GHC 106m ($8.9m) from NSA Kumawu Farm Project account on five accounts without spending any money for di project.

According to di charge sheet, Osei Assibey also allegedly do money laundering as e transfer GHC 8.2m ($686k) directly to his personal e-zwich account wey he take collect di money – when he know say ibi proceeds of crime.

Di total value of all di counts against di former director be up to GHC 616m ($52m)

Gifty Oware-Mensah dey face five counts wey include stealing and money laundering

Di former deputy director dey accused of stealing, wilfully causing financial loss, using public office for profit and money laundering.

Di state dey accuse di former deputy director say she create one scam – to provide services to di personnel.

Prosecution dey allege say she use one private company Blocks of Life consult wey she generate list of 9,934 ghost names from di NSA official system.

According to facts of di case bifor di High Court, she go di Agricultural Development Bank (ADB) wey she claim say her company supply goods to dis 9,934 ghost names, so she need loan using di non-existent allowances as collateral.

Di bank give her di loan wey she disburse GH¢31.5 m ($2.7m) directly to her company account.

Di state further add say Gifty Oware Mensah transfer ova GHC 22.9m ($2m) of di money to anoda company wia she be director.

Prosecution argue say madam Gifty Oware-Aboagye no supply any goods or services to di national service personnel.

Di Attorney general say her actions allegedly cause financial loss to di state of about GHC 38m ($3.2m)

Gifty Oware-Mensah wey serve as former director of di National Service Authority, currently be executive committee member of di Ghana Football Association (GFA), wey she also be owner of women premier league football team, Berry Ladies.



Di former executive director Osei Assibey Antwi dey face charges wey include – causing financial loss to di state.

Latest news
Related news