12.8 C
London
Tuesday, October 14, 2025

Six tins we learn as Ghana qualify for dia fifth World Cup

Di celebrations by di Blackstars players and fans on Sunday last till late for night afta Ghana qualify for di 2026 World Cup wey go happen for USA, Canada and Mexico.

Ghana secure one of di nine automatic spots as winners of Group I, afta di last match day wit a slim 1-0 win vs Comoros.

Aside di excitement and vibes, fans and players believe say dem fit prove a point afta di kontri fail to qualify for di 2025 Afcon – di first time in 21 years.

For some of di fans and experts, dat failure go kontinu to haunt di team, but dis World Cup be chance to make a statement.

Dis be some of di tins we learn as Ghana qualify for di Mundial.

Ghana finish top of dia group wit one of highest goals

For a long time, fans and experts dey fire di Blackstars say dem no dey score goals in games. Under previous coaches, Ghana fit score one goal each game and defend.

But tins dey change wit di quality of players wey dey dis squad. Ghana be one of six teams to score 20 goals or more (23 goals) for di qualifiers.

Dem score nine goals vs Central African Republic (home and away) and six goals vs Chad.

Dem also score four goals vs Madagascar. In all dem win eight games wey dem lose one and draw one to get 25 points in total.

Wit di way dem dey score goals, di fans hope say tins go Kontinu like dat into di world cup proper.

Ghana qualify for di fifth time in di last six tournaments

Dis be di fifth time Ghana dey qualify for di world cup since dem first reach di Mundial in 2006. In dat year dem advance to di second round bifor Brazil defeat dem 3-0 to boot dem out.

In 2010, Ghana reach di quarterfinal but dem miss out on di semis through penalties vs Uruguay afta Luiz Suarez controversial handball deny Ghana di winning goal in extra time.

Asamoah Gyan miss di penalty wey follow bifor Uruguay comot Ghana for di shootout.

Dat be Ghana highest finish, since dem comot for group stage for 2014 in Brazil and 2022 in Qatar. Di Blackstars fail to qualify in 2018 for Russia.

“Wit dis qualification, we go go far dis time, we get all di quality players to do well for dis tournament,” one fan Rafael Ansong tok BBC News Pidgin for di stadium afta di game

Jordan Ayew lead di team from di front wit 14 goal contributions

Di 34-year-old Leicester City striker be di captain of di team, afta im brother Andre Ayew comot di team.

Ayew carry di Blackstars on his shoulders for dis qualifiers wey he lead by example wit 14 goal contributions ( 7 goals, 7 assists).

As tins stand he dey lead for di Caf World Cup qualifiers goal contribution chart – same category wit Mohammed Salah – 12 goal contributions (9 goals, 3 assists).

Algeria forward Mohammed Amoura get 12 goal contributions (8 goals, 4 assists), Denis Bouanga of Gabon also get 10 goal contributions.

Ghana go hope say dia captain go inspire di team to perform for di World Cup proper for USA, Mexico and Canada.

Ghana coach reach record three World Cup Tournaments (one as player and two as coach) but…

Coach Otto Addo – di man under pressure afta he fail to qualify Ghana for di 2025 Afcon. Fans and football experts put pressure at di time for di football association to sack am.

But di GFA back di Dortmund-trained coach and player scout on im second-coming to coach di team.

Even tho di Afcon qualifiers be horrible, di World Cup qualifiers provide some fine stats for di former Blackstars player.

In 2006, Otto Addo reach di tournament wit di Blackstars as a player.

In 2022, he qualify di team to play di World Cup for Qatar as coach.

Dis be di third time he dey reach di competition; di second time as coach.

Even afta getting 25 points from 10 games to win dia group, some fans still figure say Otto Addo no reach dat level yet.

Ghana sports minister Kofi Adams say “di coach be lucky. E no mean say he no fit improve. I also no fit talk say he be incompetent, but I no dey satisfied.”

Di minister tok local media network Joynews say “concerns still dey, we qualify but sometimes we dey on di edge of our seats for some of di games, tins for improve.”

Di football association say dem dey back dia man – from now till di World Cup next year, many tins fit happen.

Ghana president John Mahama say make dem give di coach space to work.

Inside one interview wit Sporty FM, President Mahama tok say “make we give di management and technical team some peace. I know say we be 33 million coaches for Ghana but make we keep our coaching to ourselves, and make di coach do his job.”

Some key players for step up dia game wit di Blackstars

Many of di players for di team dey shine for dia clubs for Europe and America.

Antoine Semenyo from Bournemouth currently dey on fire for di Premier League – wit six goals and three assists so far.

He tok BBC Sports say he dey “di form of im life.”

But in di Ghana jersey, Semenyo score only three goals and one assist from 27 games.

He come under pressure from fans to show some of di form wey he get for England.

Same wit Inaki Williams, di captain of Athletic Club wey dey struggle anytime he play for Ghana.

Inaki be one of di biggest stars for Spain wia he score 100 goals in 481 official games for Athletic Club.

Since im debut, he only score two goals – against Madagascar in 2023 and Central African Republic in June 2024.

Mohammed Kudus score di only goal in di final home game against Comoros – bifor dat, di Tottenham Hotspurs score one wit four assists for his new club for England.

But he score two goals against Egypt for di 2023 Afcon for Ivory Coast.

Leicester City forward Abdul Fatawu Issahaku, LA Galaxy forward Joseph Paintsil, Thomas Brandon-Asante and di odas gat to raise dia game to push Ghana forward.

Di fans love dia football; di love din return

Bifor now wen di players no dey deliver wey di team dey lose games – di fans vex wey dem decide not to go to di stadium to watch games.

Around dat time, tins scatter, experts say di football association dey in tatters and players no dey give 100% for di national team like dem dey show for dia clubs.

Even some fans boycott di team indefinitely – wey advocacy groups put pressure for reforms for di football association and di management of di team.

Odas also tok say make di management focus on local base players and groom dem to di national team if di foreign-base players no dey pull dia weight for di Blackstars jersey.

For di last home game vs Mali wey Ghana win 1-0, ova 15,000 fans go di stadium to watch di game afta di national sports authority block one area for maintenance.

But for di final game vs Comoros on Sunday, more dan 30,000 fans go di stadium to watch di game wey dem chant di players throughout di game.

Di sports authority print 35,000 tickets – VIP, VVIP, Centre line, popular stands, evri wia full for dis last game.

Afta di game, di team thank di supporters say dem full di stadium.

“We see your energy, your passion, and support throughout dis qualifiers,” di Blackstars team tok inside one statement.



Some of di senior players for di team deliver to lead di blackstars to di world cup again

Latest news
Related news