Emergency services for di scene afta di attack on Thursday morning
Four pipo injure for inside one motor accident and stabbing attack for one synagogue for Manchester, police authorities don shoot di suspect.
Di incident hapun on Yom Kippur – di holiest day for di Jewish religious calendar.
UK Prime Minister Keir Starmer say di attack for di synagogue for Crumpsall shock am.
“Di fact say dis happun on Yom Kippur, di holiest day for di Jewish calendar, make am all di more horrific.
Hia na wetin we know so far.
Wetin happun?
Police bin respond to reports on Thursday, 2 October around 09:31 BST on Thursday say one car bin drive go jam members of di public, and dem stab one man.
Di incident hapun for Heaton Park Hebrew Congregation Synagogue for di Crumpsall area for di north of di city.
By 09:37, Greater Manchester Police (GMP) declare am as major incident.
Di force for statement tok say: “Greater Manchester Police firearms officers fire shots at 09:38.
“Dem shoot one man wey dem believe to be di offender.”
Di North West Ambulance Service confam say na major incident and dem deploy dia staff go di scene.
Di man wey dey stabbed na one security guard, police and Greater Manchester Mayor Andy Burnham tok.
How many pipo injure?
Paramedics don land di area and dem see say four pipo injure.
Police tok say di wounds na from both di accident plus di stabbing.
Dem shoot anoda man wey police believe say na di offender.
Manchester Mayor Andy Burnham confam di belief but tell BBC Radio Manchester say dem no fit confam am yet.
One eyewitness, Gareth wey follow BBC Radio Manchester tok say im bin dey drive im delivery van at di time of di incident.
E say im bin dey inside traffic, and tink say na “normal collision”, but as e go closer im see one man “wey dey bleed for ground”.
Gareth say im see anoda man “wey lie down for floor” for front of one car, and e hear pipo dey shout.
E say im see anoda pesin, one man wey hold knife and dey use am “stab di window” of a nearby building “and dey try to get in”.
“Within seconds, di police land, dem warn am but e no hear, so dem open fire,” Gareth explain, e say di man wey hold knife later fall for ground.
Di man “start to dey get back up and di police shoot am again”, Gareth tok – e describe di scene as “nerve-racking”.
Di incident still dey go on?
Burnham say “e be like say di immediate danger dey ova”.
But dem don warn members of di public to avoid di area and allow police deal wit di incident.
Police tok say dem don declare “Plato” moments afta dem hear about di mata.
Operation Plato na set of responses by di emergency services to large-scale incidents wey include “marauding terrorist attacks”.
Wetin be Yom Kippur?
Yom Kippur na di holiest day for di Jewish religious calendar. Large numbers of pipo dey attend synagogues and fast dat day.
Prime Minister Sir Keir Starmer say im thoughts dey wit di loved ones of all dos wey dey affected, and e thank emergency services plus all di first responders.”
E go chair one meeting of di govment emergency Cobra committee for London today afternoon, as e dey leave one European summit for Denmark for di meeting.
Conservative leader Kemi Badenoch tell BBC say e be like “an outrageous attack on di Jewish community on dia holiest day” – she call am “vile and disgusting”.