South Africa pause applications from asylum seekers wey be undocumented migrants afta violent protests
Wia dis foto come from, RAJESH JANTILAL / AFP via Getty Images
Di South African govment on Friday, 9 October, announce say dem dey withdraw one controversial directive wey regard di intake of asylum seeker applications from pipo wey bin enta di kontri illegally.
Di move dey come hours afta violent anti-migrant protests rock some areas of di kontri including for Soweto near Johannesburg and di coastal city of Durban.
Di kontri Home Affairs department tok for one statement say operations bin dey overwhelmed within a mata of days afta di directive bin dey issued, and say govment officials dey at risk.
Dis directive bin come into force on September 28 afta constitutional court ruling say migrants wey bin enta di kontri illegally no suppose dey denied access to di asylum application process.
Di move bin lead to long queues of migrants outside many govment buildings. Migration na big issue for South Africa and di court ruling cause anger amongst some anti-migrant groups, wey lead to outbreaks of violence.
On Thursday, protesters burn cars and some foreign-owned shops bin dey attacked. Di govment say today U-turn no be political decision and say dem go explore oda ways of honouring di Constitutional Court ruling.
one hour wey don pass'We pay ransom in dollars to free our children' – Parents of kidnapped prospective corps members tell BBC8th October 2026Three tins to know about new fees US dey propose for foreign students8th October 2026End of content
Comments (0)
No comments yet. Be the first to share your opinion!