Kano State Govnor Abba Yusuf divorce im wife, Zainab Musa Kwankwaso?
Wia dis foto come from, Abba Kabir Yusuf/ X
Kano state govnor Abba Kabir Yusuf don stir controversy afta some comments e make about im marriage, during one event wey hold for di state government house.
As e dey address pensioners on Monday, di govnor bin jokingly announce for public say im marriage to Zainab Musa Kwankwaso, niece of im former political mentor, Rabiu Musa Kwankwaso don end.
Im comments don spark debate for social media, as some pipo believe say di govnor no suppose make some comments publicly, especially dos wey concern im family.
For di weekend, local media report say di Kano govnor wife, Zainab, don file for divorce for one court for Abuja, as she dey seek to end dia marriage.
Kano State Govnor Abba Kabir Yusuf make one coded remark on Monday following reports say im wife, Zainab Musa Kwankwaso, don file for divorce for court.
Governor Abba say, “Doa wey know, know,” witout giving any further explanation.
For di same video, dem also hear am say: “If na white paper na wetin dem need, den we don give am, make evribodi rest, na dat be dat.” Somtin wey many pipo believe say e dey tok about divorce paper.
E add say: “And we fit instruct di Commissioner of Information to issue one statement and advertise am for social media so dat dos wey wan fill di vacant position fit write application. If you know, you know.”
However, some pipo believe say e dey respond to im wife, Zainab Musa Kwankwaso, wey e don spend 20 years in marriage wit, at di same time e dey propose to add anoda wife.
Dem say Zainab Musa Kwankwaso na niece/daughter of former Kano State Govnor and Senator Rabiu Musa Kwankwaso.
She marry Kano State Governor Abba Kabir Yusuf for 2006, and di 20-year marriage produce six children.
Di wahala follow long political and personal disagreement between Govnor Abba Kabir Yusuf and im former political mentor and father-in-law, Rabiu Kwankwaso.
According to reports, for middle of November 2026, Zainab file for divorce for one court for Abuja and offer to return her dowry/bride price.
On November 16, 2026, Govnor Abba Kabir Yusuf publicly hint about di end of di marriage during one official event for Kano Govment House.
Many people don condemn di govnor action of coming out publicly to tok about divorcing im wife, Zainab.
One Al'ameen for X say: “I no like di way Gov. Abba Kabir Yusuf divorce im wife, Hajiya Zainab Musa Kwankwaso, on top public podium today, but I also no go put all di blame on am.
Di ex-wife suppose don know better dan to throw away 20 years of marriage and six children sake of politics. I also blame Kwankwaso for much of wetin don happun.
You no suppose use marriage as a tool to hold person hostage or force am to bicom your political stooge.
Kwankwaso definitely dey part of di problem. No way both Ganduje and Abba go turn dia backs on am if e respect imself and understand say supporting a politician no mean say you go control elected govnors. You no fit expect sitting govnor to surrender dia independence and political authority to you.”
Ibrahim Macduff say: “You expect her to stay for marriage wia her husband dey plan evil against her papa? I keep hearing pioo dey say she no be im biological daughter. Dis one prove say Kwankwaso raise her just like im own children.”
Anoda Sarkin Yaki Na Baba Buhari say: “I no like bringing family matters into politics and making dem public! 20 years no be two days. Why take di matter to court and make am public? Na sign to damage im political image, na dia she make mistake.”
Nosyz man say: “You know how painful e dey when your husband betray your papa? Her papa allow di marriage bicos of di love wey e get for Abba, yet Abba betray am despite evritin wey e do for am… Kwankwanso go get additional sympathy votes.”
Comments (0)
No comments yet. Be the first to share your opinion!