Wetin make di new Ghana currency notes different

Wetin make di new Ghana currency notes different

Di Bank of Ghana don introduce fresh currency notes for circulation for di kontri from 12 November 2026.

According to di Central Bank, di fresh cedi notes na upgrade of di existing one wey already be legal tender.

Dem dey call di new notes – Heritage series.

Di core design for di current notes bin dey for more than 20 years na so authorities figure say time don reach for new design.

Currently di kontri get eight currency notes – Ghc1 Ghc 2 Ghc 5 Ghc10 Ghc20 Ghc 50 Ghc100 Ghc200, di new notes go reflect dis notes.

Di Central Bank no dey create any new denomination.

“Di value of di cedi no dey change.”

Di Bank of Ghana go begin circulate di new notes on 1 December 2026.

Dem go do education campaign across di kotri to help pipo understand di features on top di new notes.

President John Mahama for di launch ask Ghanaians to “carry di cedi note wit pride and uphold di confidence on which e dey rest to continue to serve Ghana securely and well for generations to come.”

“As dis notes dey find dia way to our markets, our homes and our pockets, make e deepen our appreciation of wetin we share,” di president add.

1. Di Ghc 1 note di lowest denomination get di picture of Agnes Oforiwa Tagoe-Quarcoopome, wey represent di kontris market women and dia hardwork for di market.

Agnes na di textile merchant for Accra and market queen for di 1940s wey she be di first market woman to open bank account at dat time.

For di back of di ghc1 be picture of di Makola market and cola nut wey dey represent wealth and unity

2. GHC2 dey represent di kontris faith wit picture of ogbonge Cardinal Peter Dery wey be trailblazer Catholic Church wey serve as di girst Bishop for Wa and later Archbishop of Tamale

For di back of dis note na di iconic Larabanga mosque – di oldest mosque for Ghana and one of of di oldest for West Africa. Di note also get ‘Nyame Dua’ wey get spiritual and cultural significance for traditional African religion.

3. Di Ghc 5 note bin dey represent di kontris educational history.

Dis note get di image of one Ghanaian missionary, teacher and pan-Africanist James Kwagir Aggrey wey dey popular as di ‘papa of education’.

For di same note, di photo of one of di kontris ogbonge schools – Achimota school dey.

Achimota bin raise four former presidents of di kontri and oda top politicians.

4. Ghc 10 cedi note dey represent Justice and equity. For dis, di kontris first female judge Annie Ruth Jiagge bin dey di front of dis note togeda wit di Supreme Court building and oda cultural symbol.

5. Ghc 20 note dey represent di culture and entertainment industry of di kontri.

E get di photo of Ghanaian poet, composer and music scholar Dr Ephraim Amu wey write many patriotic songs for Ghana.

Di note also get photo of di kontris iconic national theatre and some oda adinkra symbols.

6. Ghc 50 note dey represent Nationalism.

E get di picture of di woman wey design di kontris flag, Theodosia Okoh, togeda wit di image of di seat of govment and oda adinkra symbols.

7. Ghc 100 note dey represent peace and unity. Na so di picture of Kofi Annan wey be diplomat wey serve as di seventh Secretray-general for di United Nations from 1997-2006. Di note also get di image of di Kofi Annan Peacekeeping Training center and some adinkra symbols.

8. Ghc 200 note na di highest note for di kontri. Dis note dey represent di kontris sovereignty. E get di image of di kontris first president Dr Kwame Nkrumah wey lead Ghana to independence for 1957.

Di note also get di photo of di Kwame Nkrumah Mausoleum for Accra togeda wit some adinkra symbols.

Governor of di Bank of Ghana Dr Johnson Asiama tok say di new notes “get enhanced security features, improved durability and modern design wey dey reflect di kontris heritage.”

Im also add say di new notes dey designed go “protect against counterfeiting wey e go withstand prolonged circulation.”

Director for currency management for di Central Bank oga Dominic Owusu say di new series dey meet modern standards.

“Di new bank notes dey portable, easy to handle wey dem fit enta pipo dia wallet easily.”

Im add say “di current Ghc200 note for example too big, na one of di biggest note for di world, pipo dey struggle to pt for wallet, na so we decide to make di new note smaller and easy to use for business.”

According to di Bank of Ghana, di fresh notes go circulate togeda wit di old one.

Both notes remain legal tender for di kontri na so pipo gatz use dem for dia business, however, di new currency no involve coins, na only di notes.

“Dis heritage series no mean say di existing cedi notes no go dey for circulation; di old and new notes go dey circulate togeda,” Dr Asiama add.

Di bank later warn say “no need for di public to rush to exchange or withdraw di existing notes for di new ones.”

Dem also tok say pipo for no crumple or write on top di new notes so say e go fit last for long.

Authorities dey also warn say make di public no shower or spray dis fresh currency notes wey dem for no use dem for money bouquets.

“Dis go preserve di currency and reduce di cost of replacing di notes when dem damage,” governor Asiama explain.

📰 Original Source Attribution

Reported by pidgin.informationng.com.

Read Original Report at pidgin.informationng.com ↗
Share: WhatsApp WhatsApp
💬

Comments (0)

Join the Conversation

No comments yet. Be the first to share your opinion!

You may like