Ghana introduce new currency notes

Ghana introduce new currency notes

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO/AFP VIA GETTY IMAGES

Di Bank of Ghana dey introduce fresh currency notes for circulation for di kontri from 12 November 2026.

According to di Central Bank, di fresh cedi notes na upgrade of di existing one wey already be legal tender.

Dem dey call di new notes – Heritage series.

Di core design for di current notes bin dey for more than 20 years na so authorities figure say time don reach for new design.

Currently di kontri get eight currency notes – Ghc1 Ghc 2 Ghc 5 Ghc10 Ghc20 Ghc 50 Ghc100 Ghc200, di new notes go reflect dis notes.

Di Central Bank no dey create any new denomination.

"Di value of di cedi no dey change."

3 hours wey don passWhy Ghana reverse passage of controversial anti-LGBTQ bill11th November 2026Ghana dey sell diplomatic and service passport give pipo wey no qualify?9th November 2026End of content

Wia dis foto come from, NICHOLAS SEUN ADATSI BLOOMBERG VIA GETTY IMAGES

Governor of di Bank of Ghana Dr Johnson Asiama tok say di new notes "get enhanced security features, improved durability and modern design wey dey reflect di kontris heritage."

Im also add say di new notes dey designed go "protect against counterfeiting wey e go withstand prolonged circulation."

Director for currency management for di Central Bank oga Dominic Owusu say di new series dey meet modern standards.

"Di new bank notes dey portable, easy to handle wey dem fit enta pipo dia wallet easily."

Im add say "di current Ghc200 note for example too big, na one of di biggest note for di world, pipo dey struggle to pt for wallet, na so we decide to make di new note smaller and easy to use for business."

According to di Bank of Ghana, di fresh notes go circulate togeda wit di old one.

Both notes remain legal tender for di kontri na so pipo gatz use dem for dia business, however, di new currency no involve coins, na only di notes.

"Dis heritage series no mean say di existing cedi notes no go dey for circulation; di old and new notes go dey circulate togeda," Dr Asiama add.

Di bank later warn say "no need for di public to rush to exchange or withdraw di existing notes for di new ones."

Dem also tok say pipo for no crumple or write on top di new notes so say e go fit last for long.

Authorities dey also warn say make di public no shower or spray dis fresh currency notes wey dem for no use dem for money bouquets.

"Dis go preserve di currency and reduce di cost of replacing di notes when dem damage," governor Asiama explain.

📰 Original Source Attribution

Reported by bbc.com.

Read Original Report at bbc.com ↗
Share: WhatsApp WhatsApp
💬

Comments (0)

Join the Conversation

No comments yet. Be the first to share your opinion!

You may like