Nigeria evacuate Ebola patient to Switzerland afta govment release 10billion naira emergency funding
Wia dis foto come from, Fabrice COFFRINI / AFP via Getty Images
Nigeria don evacuate Ebola patient wey be di first confirmed case since ova a decade.
Dem evacuate di patient to Switzerland through air ambulance.
Nigeria health minister Ali Pate say kontri only case of Ebola virus dey evacuated to Switzerland along wit her husband by air ambulance on Monday.
Dis na afta Nigeria govment don release ₦10bn ($6.7m) in emergency funding to support laboratory testing, purchase protective equipment, mobilise health workers and strengthen oda containment measures, afta di kontri confam one case of Ebola virus.
Di 42-year old Ugandan-born wife of Swiss diplomat dey declared Nigeria first case of di virus last Tuesday.
Di health minister say di patient dey clinically improved, stable, conscious, communicating, and her clinical laboratory test results closing towards baseline.
"Dis no mean she no still dey infectious, hence di strict protocols in place.", Pate add
Di patient husband remain asymptomatic according to health officials.
24th October 2026'How I survive Ebola for Nigeria' – Survivor share experience22nd October 2026Shark kpai 65-year-old swimmer for South Africa east coast21st October 2026End of content
"I confam say, wit my approval, earlier dis morning, di index case for Nigeria first imported Ebola virus disease depart Abuja for Switzerland.", Ali Pate tok for post on X.
Di health minister say officials go provide details about di patient and her husband later today.
Lagos state: Govnment say di state dey on high alert. Di state commissioner for health Prof Akin Abayomi highlight seven preparatory measures dem don put in place, wey include upgrade of isolate centres for di state, screening at aiports plus oda points of entry, simulation, laboratory testing among odas.
E add say retraining of health workers across public and private facilities on infection prevention and control don start.
"One dedicated Ebola Research Committee don dey review di latest evidence on treatment and vaccines to guide our decisions," Abayomi tok.
Delta state: Di state commissioner for health, Joseph Onojaeme say di ministry of health dey strengthen surveillance at entry points, health facilities and within communities, while prioritising regular training for frontline health workers, public awareness campaigns plus di provision of essential medical supplies to support emergency response efforts.
Na on 20 October, di kontri health minister announce say Nigeria govment don confam one case of Ebola virus for di Federal Capital Territory (FCT) and na for di body of ome woman wey recently land Nigeria from Uganda.
Di 42-year-old woman na di wife of one Swiss diplomat.
Di case wey involve di Bundibugyo strain, one rare form of Ebola virus disease wey don affect some African countries.
Health officials dey investigate weda Nigeria first case bin cross paths wit Kenya first patient. Believe dey say both of dem travel through Uganda Entebbe International Airport earlier dis month.
Ebola na one severe and often fatal disease. E dey spread through direct contact wit di blood or oda bodily fluids of infected person, or through contaminated materials. E no dey spread through di air.
Prof Pate don ask Nigerians to remain calm but vigilant, follow public health guidance and immediately report symptoms or suspected exposure to health authorities.
"We need Nigerians to cooperate wit health workers, observe di recommended public health protocols at home and for public places, and seek medical attention if dem develop symptoms or believe say dem fit don dey exposed," e tok.
However, di imported infection don bring back concerns about public health preparedness for kontri of more dan 200 million pipo, particularly for densely populated urban communities wia poor sanitation and limited access to healthcare fit increase vulnerability in case di virus spread.
Comments (0)
No comments yet. Be the first to share your opinion!