Nigerian govment approve 90 days economic action to reduce cost of living – wetin e mean

Nigerian govment approve 90 days economic action to reduce cost of living – wetin e mean

Wia dis foto come from, Nigerian presidency

Wia dis foto come from, Stanley Nwokocha/X

Di Federal govment of Nigeria don approve 90 day economic plan wey dem say go reduce di cost of living for Nigerians.

Nigerian govment take dis decision di National Economic Council meeting on Thursday, 22 October during d wey di Vice President Kashim Shettima chair.

Di economic council approve di 90-day action plan wey di Federal Ministry of Finance bring.

According to one statement wey one of di tok-tok pesin to di Vice President Stanley Nkwocha issue, na di Minister of Finance Taiwo Oyedele present di plan bifor di national economic council

Dem say di economic plan go focus on how to reduce di cost of living, make food affordable for Nigerians and attract investment across di kontri.

According to di 90-day proposal, dem also wan use am speed up projects wey go bring direct benefits to Nigerians.

16th October 2026Tinubu appoint six new top Inec officials 16th October 2026All you need to know about new Suicide (Prevention) Bill Nigeria senate dey consider14th October 2026End of content

According to di plan wey Minister of Finance Oyedele present bifor di national economic council na five area of priorities dem wan focus on.

Di council also approve di establishment of one national dashboard wey go track projects across di kontri, wit emphasis on transparency and accountability.

Di dashboard go also report how dem dey use di profit from fuel subsidy removal.

📰 Original Source Attribution

Reported by bbc.com.

Read Original Report at bbc.com ↗
Share: WhatsApp WhatsApp
💬

Comments (0)

Join the Conversation

No comments yet. Be the first to share your opinion!

You may like