13.1 C
London
Thursday, October 30, 2025

Chukwudi Nwachuku: Sex trafficking suspect sentenced to 10 years imprisonment for Ghana

Girl wey dey hide her head for her legs or wetin look like school hall

Wia dis foto come from, SDI Productions via Getty Images

Wetin we call dis foto, Nwachukuwu bin carry ten girls wey include im sister enta prostituition for Ghana

One Circuit court for Ghana don sentence Nigerian Chukwudi Nwachuku to 10 years imprisoment for sex trafficking.

Dis na sake of say di 29-year-old carry im younger sister and nine oda girls from Nigeria go Ghana to do sex work.

Di court wey Akosua Anokyewaa Adjepong preside ova find Nwachuku guilty on di two counts and sentence am to 10 years imprisonment for each count wey go run concurrently.

Di judgement also tok sat make di convict give 15,000 Ghana Cedis ($1,382) to each of im 10 victims.

Di court tok say even though Nwachukwu na first time offender, dem sama am dat judgement to take draw ear give oda pipo wey dey run dis kain parole.

Di victims dey between di age of 15 and 18 years and tori be say dem tell dem from Nigeria say dem dey go work for restaurant but na prostitution dem go meet for Ghana.

Prosecution say im make im victims dey submit 300 Ghana Cedis give am evri dey afta dem don do sex work for a part of Ghana capital city of Accra wey dem dey call Odorkor.

According to di case wey prosecution bin bring come front, na one member of di Nigerians in Diaspora Organisation for Ghana, Chief Calistus Elozieuwa bin open di fowl yansh wey lead to di rescue of di victims.

Assistant Supritendent of Police Isaac Babayi tok say for 7 June, 2024, di Anti-Trafficking Unit for CID Headquaters get report from di Nmai Dzorm Police station say oga Elozieuwa and im team gbab Nwachukwu and rescue di victims.

Di court hear say Nwachuku get di girls from collabo wit pipo wey dem dey call agents wey dey find girls from villages for Nigeria and wen di girls reach Ghana, Nwachukwu keep dem for im house for Liberia Camp near Kasoa.

Tori be say e collect hair for dia private parts and make dem swear for shrine bifor im threaten dem say dem go get skin disease wey no get cure if dem disobey am or carry di money wey dem make run.

Afta dat Nwachukwu give di girls waist beads from di shrine bifor e carry dem go Odorkor traffic light, force dem to do prostitution dey write di money wey dem make per day for note book.

For April, di Chairman/CEO of di Nigerians in Diaspora Commission (NIDCOM), Abike Dabiri-Erewa reveal say so far, na about 200 girls wey dem don rescue from Ghana say dem bin dey trafficked in di past months.

She tok dis one for press release say she thank di Chairman for NIDO Ghana Board of Trustees, Chief Callistus Elozieuwa for di work wey im dey do to fight against trafficking.

She add say, “human trafficking no go stop if pipo wey dey do am and dia agents no dey exposed and shamed”.

She say while di National Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) dey steady rescue victims and gbam criminals, human trafficking still dey on di rise world wide bicos pipo no gree to “name and shame di pipo ey dey behind di mordern day slavery”.

Latest news
Related news