12.5 C
London
Sunday, October 12, 2025

Ghana vs Comoros live : Kudus score as Blackstars lead Caf World Cup qualifiers match

key players for both teams - Antoine Semenyo and Youssouf M'changama

Wia dis foto come from, GETTY/MB MEDIA VIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Ghana only need one point to confam dia place for di world cup, but Comoros dey hope to spoil dia party

Second Half

46″ GOOOOOAL! Mohammed Kudus slam di ball into di net afta Partey hit di shot. Ghana lead 1-0

Ghana already trying to begin some attack but di Comoros backline choke.

45″ Said Bakari dey replace Banjaloud Youssouf for Comoros

Di players comot for di second half now, Ghana go begin di kick off.

First Half

45″ Adjetey try to strike one from distance – di ball go ova di bar. Dat be di final action for dis half.

Ghana dey try build from di back but he slow di ball down to make hiss team mates get involved.

Dem add two minutes bifor di break, any of di teams fit get di goal bifor halftime?

44″ Kudus try to shoot from long range afta dem pass am one ball for di right hand side. Comoros block di shot

43″ Anoda corner to Ghana, Adjetey try to head di Jordan corner but dem defend am.

42″ Ghana win anoda corner, some good work from Kudus to create space and cross di ball into di box but Comoros defender clear di ball for corner.

41″ Ghana keeper Benjamin Asare collect one long cross ova di top wey dey go to Comoros player; di fans appreciate di save.

For di oda game, Mali dey beat Madagascar 2-0, we mean say Ghana dey sit comfortably for di top of di group with four points now.

40″ Djiku and Salisu combine to clear one long ball ova di top – wey di fans dey cheeer.

39″ Di game restart, di Comoros keeper dey fine to continue.

38″ Di Comoros keeper Adel Aboudou dey sit for ground. Medical team dey treat am while di Blackstars players dey observe cooling break.

36″ Chaaaance! Jordana Ayew beat two, three players insisde di Comoros box bifor he try to chip one small cross back into di box, but Comoros clear

34″ Jordan Ayew’s corner no trouble di Comoros backline. Dem clear di danger, bifor Alidu Seidu fail to control di lose ball – throw-in for Comoros.

33″ Semenyo try to shoot on goal, wey di ball comot for corner. First corner for di blackstars.

32″ Di ball fly into di box, Comoros try to clear, but di ball fall for Semenyo, wey he take come out of di box and pass to his teammate

31″ Freekick to Ghana in front of di Comoros box afta Youssouf foul him. Chance for Ghana?

30″ So far none of di teams create any clear cut chances for dis game.

29″ Alidu Seidu and Ismael Boura jump to challenge one ball, di Comoros player dey worse, but after few seconds he rise for di game to continue.

28″ Jordan Ayew try to thread one ball inside di backline for Kudus, but Comoros block di supply

26″OFFSIDE! Rafiki Said figure say he score but lineman raise flag for offside.

23″ Comoros launch one long throw into di box, but Alidu Seidu clear di ball

20″ Comoros dey find dia feet inside dis game now. Dem dey cause some trouble for di Ghana defence.

18″ Freekick to Comoros close to di Ghana box. But di freekick dey straight into di hands of di Ghana keeper.

16″ Jordan Ayew try to reach one through pass from Salisu but di Comoros defender bully him off di ball

15″ Rafiki Said from Comoros concede throw-in, di ball dey back to di blackstars area.

13″ Afta Ghana endure di Comoros pressure, dem begin dia own attack thru captain Jordan Ayew, but di Comoros keeper punch di ball away

10″ Yellow card for Kwasi Sibo as he hack down Faiz Selemani for di centre circle.

Alidu Seidu gift possession again. Di wing back so far no dey see top.

9″ Di game dey quiet for di last few minutes, both teams dey struggle to create any beta chance.

7″ Alidu Seidu foul di Comoros cpaptainYoussouf M’chanangama. Ref whistle for freekick

6″ Partey misplace one pass afta dat Kwasi Sibo foul his marker – ref blow whistle but di fans disagree.

4″ Ghana try to build up afta dat early chance from Comorso but dia keeper comot come grab one through ball for di box

3″ Chaaance for Comoros afta Benjaloud Youssouf beat Alidu Seidu for di right side wey he cross di ball inside di box, but di Comoros attacker head di ball over di bar.

2″ Early throw-in for Ghana for Semenyo to lift di ball inside di Comoros box.

Ghana already dey try to start di buildup, di fans dey roar to every touch so far.

1″ Ref blow whistle for di game to start – Comoros kick off for dis half.

Pierre Ghislain Atcho be di centre referee.

Thousands of fans dey di stadium to see dia players play dia final qualifying game.

Di blackstars carry kente stole around dia neck as di national anthem blast through di speakers.

Ghana dey wear dia all yellow jersey wey Comoros dey wear all-green jersey.

Both teams comot for park now, wey dem dey sing dia national anthems

Hello welcome everibodi to di capital of Ghana – Accra where dis match between Blackstars and Comoros dey happen

Few minutes bifor di game between Ghana and Comoros for Accra.

Ghana get one leg for di World Cup, dem dey need only one point to seal di deal.

Dem go still qualify if dem lose wey Madagascar win.

For Madagascar to win di group, dem for score at least eight or more goals vs Mali to beat Ghana on goal difference.

If dem still tie wit goal difference, then dem go look at di number of goals both teams score.

Ghana dey enta dis game wit 22 goals against 16 for Madagascar.

Di two coaches release dia lineup for di game.

Ghana XI: Asare (GK), Alidu Seidu, Jonas Adjetey, Mohammed Salisu, Ebenezer Anan, Kwasi Sibo, Thomas Partey, Antoine Semenyo, Mohammed Kudus, Jordan Ayew

Comoros XI: Adel Anzimati Aboudou (GK), Ismael Boura, Kenan Toibibou, Ahmed Soilihi, Faiz Selemani, Zaydou Youssouf, Youssouf M’changama, Rafiki Said, Kassim M’dahoma, Benjaloud Youssouf, Yacine Bourhane

Build up

Di Blackstars get one foot already for di 2026 World Cup but dem go finally confam dia place if dem get at least a draw from di final Group I qualifier vs Comoros on Sunday.

Ghana dey enter dis game wit full vim afta dem scatter Central African Republic 5-0 for Morocco last week.

Goals from five different players – two defenders – Mohammed Salisu and Alexander Djiku as well as Captain Jordan Ayew, Thomas Partey and substitute Kamaldeen Sulemana seal di three points afta di dominant display.

Wit dis result – Ghana get 22 points at di top of Group I, Madagascar wey win dem game 2-1 vs Comoros dey second wit 19 points.

Mali beat Chad 2-0 to dey on di same points (15) wit Comoros.

Ghana go hope to seal dia fate v Comoros for for Accra, wey Madagascar go take on Mali.

Three teams dey fight to finish second for dis group.

Chad go play wit Central African Republic wey Mali go play wit Madagascar.

All di three matches go happun at di same time.

If Ghana lose wey Madagascar win dia game, dem go dey level om 22 points wit Ghana.

Comoros national team squad

Wia dis foto come from, DANIEL BELOUMOU OLOMO AFP VIA GETTY

Wetin we call dis foto, Comoros beat Ghana 1-0 for di first leg of di World Cup qualifiers in 2023

Wetin di coaches tok

Ghana lose to Comoros (1-0) for di first leg of di group I qualifier on 21 November 2023.

Dat be di only defeat di Blackstars suffer for di qualifiers, wey dem go hope to avenge dat defeat for dis game wey go happun for di Accra sports stadium.

Ghana coach Otto Addo warn di players against ‘complacency’.

“We get di same mentality for all our games – we wan end dis qualification wit victory. Sometimes in dis game of football, you comot your eye, you fit lose. My team in di past lose one game we dey lead 4-0. Dat game end 6-4, so we for be very careful “

E add say “we want do dis one for di fans wey dey support us throughout di qualification.”

Coach Otto Addo say “we show di players plenti clips of wetin we wan do wey we dey enta dis game wit 100 percent focus.”

But di former Dortmund player scout know say tins no go be easy against di “Les Coelacantes”.

“Comoros be really good team wey dem play some good football ova di last years, so e never go be easy.”

“Even though dem lose to Mali (3-0) and Madagascar (2-1), dem create plenty chances inside those games, but wit di right mentality we fit beat dem.

If Otto Addo fit qualify for dis World Cup, he go become di only coach to carry Ghana go di world cup two times.

comoros captain in action

Wia dis foto come from, FFC

Wetin we call dis foto, Comoros coach admit say di Ghana team dem beat for 2023 no be di same team dem go face on Sunday

But Otto Addo no wan rock di boat just yet.

“I no dey tink about dat record serf, e never be about me, but di team. All I dey tink about be how to qualify for di Mundial.”

Comoros team coach Stefano Cusin say dem make ready for an upset for dis game.

“We lose di last game v Madagascar, so di team learn from dat game, from di time we beat Ghana for di first round in 2023 till now be long time, many tins change now.”

E also explain say “Ghana get good players, wey dem dey play at home, dem almost qualify, so of course everitin dey go on well for di team, but we go try our best.”

Fans go dey di stadium in dia numbers to support di Ghana team – coach Stefano Cusin say di role of those fans go dey important.

“When you play in front of thousands of fans, you expect di game to be difficult. Ghana play very well against Mali, dat be di kind of game we dey expect.”

Comoros no fit qualify for di world cup but dem fit cause upset and spoil di Ghana party.

But Stefano Cusin dey proud of di work dem do wit dia team.

“Our first target when I take ova dis team be to qualify for di Afcon wey we qualify to play in Ivory Coast, but for dis world cup, we try our best but tins no happen di way we want.”

“Wey player or coach go tok say dem no like to play for di World Cup? We all wan play but we no go reach di mundial sake of we lose some points at di start of di qualifiers.”

Di Comoros coach say Ghana be team wey suppose qualify for di Afcon easily but somehow dem fail to qualify, but dat no mean say dem be bad team.

“At di time Ghana no qualify for Afcon, because dem no dey good form. For di Afcon qualifiers, if you lose guard, you go drop, sake of di games dey happun ova a short space of time.

secene from Ghana v CAR game

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Ghana beat CAR 5-0 to stay top of Group I

Wat go be di tiebreaker if di teams get equal points

If both Ghana and Madagascar get di same points, dem go use oda tins to separate dem.

  • Overall goal difference: Di team wey get di best goal difference across all di group matches. As tins stand, Ghana get beta goal difference when you compare wit Madagascar (16 v 8)
  • Number of goals scored: Di team wey get di most goals for all di group matches. Ghana again dey lead di table for most goals scored, if you compare wit Comoros, ibi (22 v 16)
  • Head-to-head results: If afta goal difference and number of goals scored, di two teams still get di same results, den dem now go analyze results of di two matches between di teams.
  • Goal difference in head-to-head matches: Dem go check di best goal difference in di two matches di teams play.
  • Number of goals scored in head-to-head matches: Di most goals scored in matches between di two teams wey tie on points.
  • Number of away goals scored: Dem go check dis one if di tie be between two teams (Ghana and Madagascar)
  • Fair Play ranking: Dis point system dey punish cards – yellow, red, two yellow cards and straight red card.

Yellow card -1 point (minus one point)

Second yellow card/indirect red card – 3 points (-3)

Direct red card – 4 points (-4)

Yellow card wey direct red card follow – 5 points (-5)

Drawing of lots: Dis be di last tin dem go use to separate two or more teams wey tie on points. Africa go present nine teams for di 2026 World Cup. Dem fit create 10th spot for din winner of di African playoffs for di intercontinental playoffs.

blacklstars team

Wia dis foto come from, GFA

Wetin we call dis foto, Dis go be di fifth time Ghana go reach di world cup (2006, 2010, 2014, 2022)

Latest news
Related news