16.9 C
London
Wednesday, October 8, 2025

Why Kenya law President Faith Odhiambo resign from William Ruto panel

President William Ruto (L) and Faith Odhiambo President William Ruto (L) and Faith Odhiambo

Di president of Law Society of Kenya (LSK) Faith Odhiambo don resign comot from di Presidential Panel of Experts on Compensation of Victims of Demonstrations and Public Protests.

President William Ruto bin constitute di panel to address issues wey concern police brutality and victimisation during protests.

Dem appoint Faith Odhiambo as di Vice Chairperson of di panel, alongside oda lawyers and activists for Kenya according to di notice wey dey published for di Kenya Gazette for August 2025.

During di swearing-in of di panel members, Chief Registrar of di Kenya Judiciary, Winfridah Mokaya say di panel go see to di compensation process for protest victims and e go serve assurance to citizens say dia rights dey guaranteed under constitution.

But Faith Odhiambo resign on Monday 6 October, 2025 wia she give her reasons

“Accordingly, I don hand ova my formal and immediate resignation from di position of Vice Chairperson of di Panel of Experts on Compensation of Victims of Demonstrations and Public Protests to di Head of Public Service.”

LSK president Odhiambo say di panel dey constituted of correct Kenyans wit di mandate to provide legal and institutional framework on how to compensate victims but as e stand, e no dey enough to address public concerns.

For 2025 alone, several protests bin happun for Kenya wey lead to di loss of lives of young Kenyans, while some bin wunjure.

Why Faith Odhiambo bin resign

According to her, she say di oath of office wey she take for Law Society of Kenya na to preserve and uphold di rule of law and she no go allow make any opposition or adversaries bin distract her.

Odhiambo say her resignation come for time wen Kenya dey find lasting solutions to dia democracy.

“As tins be, di time-bound mandate of di Panel dey stopped by our Courts, and di proposed 120-day tenure of di Panel dey likely to end bifor di matter dey resolved and settled.”

She say di time wey dem give dem for di panel dey run, and as clock dey tick some victims dey reach out to her to ask wen di panel go grant dem audience to come tok.

Odhiambo say e no dey possible to achieve di mandate of di panel within di short time wey dem get, and she go rather dey di side of di victims.

“Unfortunately, e no dey feasible to achieve di time-sensitive milestones wey I undertake to achieve, and I gatz diafore prioritize oda avenues to respond to di plight of victims through di oda positions wey I hold, especially di leadership of di Law Society of Kenya.”

“I go kontinu to take up and prosecute matters on behalf of victims wey don experience police excesses during demonstrations, and work to get justice for victims,” she tok

Why dem setup di panel

According to di Kenya Chief Registrar, di reason why dem setup di panel na to make sure say victims of brutality and protests no dey forgotten.

“While no amount of compensation fit erase di grief of families wey lose loved ones, di process go confam accountability as di bedrock of justice, to ensure say dat kain losses no dey forgotten,” di Chief Registrar tok.

Kenya say di panel go ensure transparency while dem go also propose reforms wey address di root causes of protests and prevent make violence no happun again.

Latest news
Related news