12.4 C
London
Thursday, October 2, 2025

UK outline new conditions for indefinite leave to remain for migrants

Migrants go need prove say dem dey contribute to di society to earn di right to remain for UK, di home secretary tok.

For her speech to di Labour conference, Shabana Mahmood outline series of new conditions migrants go need to meet to qualify for indefinite leave to remain.

Under di proposals, legal migrants go need to learn English to a high standard, get clean criminal record and volunteer for dia community bifor dem fit dey granted permanent settlement status.

Labour say di policy don draw clear dividing line between di govment plus Reform UK, wey say dem go end indefinite leave to remain.

Earlier, Reform UK bin announce say dem go cancel di right of migrants to qualify for permanent settlement for UK afta five years, if di party win di next election.

Under di plans, migrants go need reapply for new visas wit tougher rules, and Reform go cancel Indefinite Leave to Remain (ILR), wey dey give pipo di rights and access to benefits.

Di main theme of Labour conference na to carry di fight go Reform UK, wey dey lead UK-wide national opinion polls.

For her first conference speech as home secretary, Mahmood tok say di story of Britain progress as an “open, tolerant, generous place” don become challenged.

Mahmood say her broad definition of patriotism dey “turn into sometin smaller, sometime more like ethno-nationalism”.

To stop dis, she say, di Labour government get to “understand why so many pipo dey feel say di kontri no dey work for dem”.

“If we no rise to dis challenge, our vision of an open, tolerant, generous kontri go fade,” Mahmood tok.

She say working-class communities go comot from Labour “and find comfort for di false promises” of Farage party.

She add say di challenge no be just about winning di next general election, but in keeping di kontri togeda and fighting for “our belief in a greater Britain, not a littler England”.

Di rise for di number of migrants wey dey cross di English Channel in small boats plus di scale of immigration to di UK in recent years na prominent themes for her speech.

Mahmood bin promise to “do whatever it takes to secure our borders”.

She confam her plans to reform indefinite leave to remain, Mahmood tok say di changes go “ensure contribution to dis kontri as a condition of living here”.

Mahmood speech bin blend di personal wit di political, as she tok about her upbringing and her background.

She tok about her parents experience of wen dem land UK, she argue say di acceptance of migrants must depend on dia contribution to local communities.

She also tok about being a victim of shoplifting, wen she dey work behind di counter of her family corner shop wen she be pikin, and why dat don motivate her to crack down on theft.

Currently, migrants fit apply for indefinite leave to remain afta five years, wey give dem di right to live, study and work for di UK permanently.

Labour dey plan to double di period e go take to gain di status from five years to 10.

Ministers dey eager for migrants to prove say dem dey integrated for di UK if dem want di settlement status.

Dat go include meeting conditions like making National Insurance contributions, dem no go take any benefits payments and dem go dey give back to dia communities.

Labour say some foreign nationals fit earn earlier settlement, based on dia contribution or skills.

Migration Observatory estimate say about 4.5 million pipo wey get indefinite leave to remain, include roughly 430,000 non-EU citizens.

Reform don tok say dem go replace indefinite leave to remain wit visas wey go force migrants – including non-EU nationals wey already get di status – to reapply evri five years.

Labour say dis go force workers wey don dey contribute to di UK for decades to leave dia homes and families.

On Sunday, Prime Minister Sir Keir Starmer say Reform UK policy dey “racist” and “immoral” for inside one interview wit BBC.

Chancellor Rachel Reeves echo im comments on Monday. She tell BBC say make dem deport pipo wey dey live for UK illegally but na “quite a different tin” to deport pipo wey dey live and work for UK legally.

“those policies na racist, and we go call dem out,” she add.

In response, Reform UK leader Nigel Farage tell Daily Express say Labour “no believe in border controls” and e say di prime minister comments na “desperate attack”.

Zia Yusuf, Reform UK policy chief, tell BBC Breakfast say pipo get “perfectly legitimate concerns about immigration” and “dem dey smart enough to know if pesin dey vote for a policy wey Starmer call racist.” wetin you tink say Starmer tink of you?”

Delegates bin listen to Mahmood politely, some even clap for her afta her speech, but as she tell dem: “In solving dis crisis, you fit no always like wetin I do.

“We go question some of di assumptions and legal constraints wey don last for a generation and more.”

Her target audience as a whole na voters wey fit dey tempted to vote Reform, and Mahmood see for di Home Office, department wey need to dey more robust in doing wetin dey necessary to make impression on di immigration numbers – legal and illegal.

Latest news
Related news