12 C
London
Monday, October 6, 2025

Ghana education service remove assistant headmaster wey ‘touch’ student inside viral video

Di GES ban di assistant headmaster from going to di school as investigations dey continue Di GES ban di assistant headmaster from going to di school as investigations dey continue

Di Ghana education service don sack assistant headmaster for di Kwame Nkrumah University of Science and Technology (KNUST) Senior High School afta im appear inside one viral video.

Di video capture Charles Akwasi Aidoo wen e dey fondle di breast of one female student for location wey look like im office.

Oga Aidoo inside di 16-sec video wey di student film, put im head on her shoulder during di action.

Days afta di video go viral, di Ghana education service say dem dey take di mata seriously.

“Management in line wit our commitment to protect di integrity of di teaching profession and di welfare and safety of students, remove di assistant headmaster from office,” di education service tok inside dia statement.

Dem add say “we also ban oga Charles Akwasi Aidoo from stepping foot for di campus as investigations dey go on according to di code of conduct of di service.”

According to di statement, di education service say dem go follow due process to ensure say dem punish di headmaster per di education service code of conduct.

Dem finally add say “we condemn any acts wey dey compromise di safety, dignity and wellbeing of students.”

Dis no be di first time di education service dey act against teachers and headmasters wey dey engage in “immoral acts” wit dia students for campus.

‘No be di first time’

For November 2018, di Ghana education service sack nine teachers and senior staff of various senior high schools for sexual and immoral misconduct.

According to one statement at di time wey tok-tok pesin Cassandra Twum-Ampofo sign, di education service say di seven engage in sex-related misconduct in breach of dia code of conduct.

Di service at di time tok say dem hope di dismissal go stop oda teachers and headmasters from engaging in sexual acts against dia students.

Education watchers dey concerned about dis development

Education watchers say dis development dey worry.

Oga for Institute for Education Studies (Ifes), Dr Peter Partey Anti tok BBC News Pidgin say di education service and oda agencies get questions to answer.

“Di headmaster break di code of conduct of di Ghana education service for dis mata. As pesin wey parents put dia children for your care for boarding school, you get to be professional to protect and handle di students, no be to sexually exploit di child.”

Dr Partey Anti add say, “any pesin wey engage for dis kind tin no qualify to be teacher. Ghana education service go discipline di teacher but we get to hear from di national teaching council (ntc) for dis mata. Na dem dey issue licence for teachers, so dem for tok sometin and revoke di license of di headmaster.”

Many pipo also dey worry about di fact say dis tins continue to hapun for schools and oda places, despite di sanctions wey di education service dey apply.

Some pipo dey blame di use of mobile phones for di boarding school – sometin wey dey illegal.

Dr Peter Partey Anti ask “how dis female student get mobile phone to even film di action wit di assistant headmaster, wen phones dey banned for senior high schools?”

“Dis mata dey bring up di fact say some teachers and headmasters dey enable dis students to break di law for campus, sake of how di student dey use phone for headmaster office?,” im ask.

Latest news
Related news