Pipo take shelter afta di Thailand and Cambodia troops begin shoot each oda
Clash between Thailand and Commbodia military for one border wey di two kontris dey drag, don kill at least 12 pipo, Thai authority tok.
Dis fight don carry di border argument, wey don dey occur for more dan 100 years between di two South Asia neighbours enta anoda level.
Most of di people wey die na civilians from three of Thailand provinces according to Thai army.
Di army also report say many oda pipo wunjure. But Cambodia neva tok weda dem to get casualties.
On Thursday, di two sides exchange gunfire wit each side claiming say na di oda first find trouble.
Di gbas gbos quickly enta anoda level as Thailand accuse Cambodia say e fire rockets, and diafore, dem fire air strikes on Cambodia military targets.
Now Thailand don close dia border wit Cambodia, while Cambodia reduce dia relationship wit Thailand, wey e accuse say dem use “excess force.”
Di two don ask dia kontri pipo wey dey live near di border make dem pack comot. Thailand evacuate 40,000 pipo comot go safe place.
“E serious no be small. We dey middle of evacuation,” Sutian Phiwchan, on area pesin for di Ban Dan district for Thailand Buriram province near Cambodia border, tell BBC.
Thai authorities say na 11 civilians, including one pikin wey dey eight years and anoda one wey dey 15 year, plus one military pesin.
Cambodia and Thailand dey tok dia own version of wetin happun.
Thailand claim say Cambodia military na dem first send drone to spy dia troop for border.
Cambodia for dia own tok say Thai sojas cause fight wen dem break one agreement wen dem carry dem sef go near Khmer-Hindu temple wey dey near di border.
Wetin dey cause fight?
Dis gbas gbos between Cambodia and Thailand begin more dan one hundred years, wen French colonial masters divide di border for di two kontris.
Tins officially enta anoda level of kasala for 2008, wen Cambodia try to register one 11 century temple wey dey for di area wey dem dey drag land, as World Heritage Site. Dis move cause serious protest for Thailand.
Di two side don dey clash for years and soldiers and civilians don die for both sides.
Dis lates tension begin gada momentum for May afta dem kill one Cambodia soldier for one clash.
For di past two months, di two kontris impose border restriction on di oda.
Cambodia stop to import tins like fruits and vegetables, plus stop importing electricity and internet service.
Both kontris don also increase di number of soldiers wey dem get for di border.
Thailand acting premier Phumtham Wechayachai say di kasala wey dem get wit Cambodia dey “delicate”, and dem must to address am wit care and according to international law.
Cambodian Prime Minister Hun Manet im kontri want make dem solve dis mata peacefully – but add say im “no get choice” but to “respond wit armed force against armed aggression”.
Serious exchange of fire between di two kontris bin reduce sharply.
But while e dey be like say di current fight fight fit no blow up turn to fill war, di two side currently lack leaders wey get enough strength and confidence to pull back from dis confrontation.