17.5 C
London
Sunday, July 27, 2025

Morocco vs Ghana highlights: Black Queens lose on penalties to set-up Nigeria vs Morocco Wafcon 2024 final

celebration

Wia dis foto come from, CAF WOMEN’S FOOTBALL

Wetin we call dis foto, Di Atlas Lionesses bin win di game for penalties afta dem no fit take di plenty chances dem create

Hosts Morocco don qualify to set up ogbonge Wafcon finale wit record holders Nigeria.

Dis na afta dem defeat Ghana 4-2 for penalties afta di game end 1-1 for regulation and extra time.

Di Atlas Lionesses bin create most of di chances wey dem control di game but dem no fit find dat goal wey go win di game.

Ghana afta dem take di early lead bin waste three ogbonge chances to extend dia lead bifor Morocco comot di break wia dem find di equalizer.

Afta 120 minutes na di Morocco keeper Khadija Er-Rmichi wia save di last Ghana penalty from Comfort Yeboah afta Evelyn Badu don miss her own earlier.

Dis result mean say hosts Morocco don enta second final in three years afta dem bin lose di 2022 final to South Africa.

Di Atlas Lionesses like Ghana neva win di Wafcon, na dis go be dia chance to see if dem fit to beat record Champions Nigeria to make history for diaserf.

For Nigeria, dem also go believe say dem fit win dia 10th title.

Penalty shootout

Ghana player Comfort yeboah take her kick wey she miss. Morocco win 4-2

Morocco player take her kick wey she score 4-2

Ghana player Evelyn Badu take her kick wey she miss 3-2 advantage Morocco

Morocco player Kenza Chapelle take her kick wey she score 3-2

Ghana player Alice Kusi take her kick wey she score 2-2

Morocco player Ibtissahm Jradidi take her kick wey she score 2-1

Ghana player Josephine Bonsu take her kick wey she score 1-1

Morocco bin take di first kick Hanane Ait El Haj don score 1-0

Referee don tok di two captains say afta dia last kick, dem gat to wait make di VAR confam bifor dem go celebrate.

Both captains bin dey toss di coin about who go first take di kick.

She fit to do am again today for dis Rabat stadium v di hosts? Na time go tell

Dia keeper Cynthia Konlan na di start for dat shootout as she don save two kicks.

Ghana bin win dia last match for di quarterfinal against Algeria from di penalty shootout 4-2.

scene from the game

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN’S NATIONAL TEAM

Wetin we call dis foto, Ghana bin lead thru Stella Nyamekye goal for di first half

Ref don end di whole game now. Penalty shootout go determine di winner dis game. Na who go win am dis time?

120+1 One Ghana player no fit to feel her legs again, she bin sit for ground wey dem dey stretch her legs. Dis game don taya everyone at dis point.

Di 120 mins don reach but dem bin add 3 more mins.

120″ Morocco try to build for di back but Ghana don clear di ball as dem bin dey try to attack; throw ball to Morocco.

119″ Time dey run out for dis two teams – afta dis na penalty shootout, unless one of dem fit grab late, late goal for hia.

118″ Morocco bin try to build on dia momentum. but dia attack don break down for di last minute.

117″ Di cross inside di box no find di Ghana teammate wey Morocco now clear.

116″ Chance for Ghana but dem no get di concentration to take dat chance.

Dem bin comot di player wey hurt on top stretcher wey dem change her.

113″ Injury to one Morocco player as dem clash knees. She bin dey receive treatment.

107″ Dangerous corner kick but Ghana no fit take advantage. Morocco now dey attack but di ball comot for throw-in to Ghana.

106″ Corner to Ghana. Di new Morocco captain Hanane Ait ElHaj don vex say ref collect di corner for Ghana.

Game don restart, Ghana win quick freekick for di centre line.

15 minutes more to decide who go win dis game. Na Ghana or Morocco?

scene

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN’S FOOTBALL TEAM

Wetin we call dis foto, Di game dey tight but Morocco bin create di most chances for di second haldf

Dem whistle for halftime of di extra time.

105″ Morocco bin make anoda change, straight from dat change, dem bin attack but dia final ball too weak, Ghana try to attack wit Grace Asantewaa, she bin drive di ball by herserf bifor she pass to Princella Adubea, but as she try to beat her marker, dem bin blow whistle for offside.

103″ Morocco captain Chebbak bin dey get chance to hold di ball wey she bin dey dribble many players for di Ghana area, dat na her last contribution bifor dem bin change her.

102″ Morocco take advantage of Ghana poor passes to attack wia dem almost score, but di final pass too strong.

101″ Ghana bin dey make anoda change, Sherifatu Sumaila bin replace Chantelle Boye-Hlorkah.

100″ Ghana attacker Adubea bin try to enta di Morocco area wia di defender use hand brush her face, ref say no foul but di Ghana striker dey for ground. she don dey receive treatment.

99″ Chance for Ghana! Morocco keeper fumble one long cross into her areaa di ball fall to Evelyn Badu but she don rush wey she head di ball ova.

98″ Freekick to Ghana as dem foul di Ghana captain Portia Boakye as she bin dey try to carry di ball from defence into midfield.

Offside! Chantelle Hlorkah im cross to Alice Kusi dey too high, but before she fit reach di ball ref whistle say offside.

96″ Jennifer Cudjoe bin dey pant for breath but she still try to run to block one ball from di Morocco attacker. Ref say throw-in to Ghana, di Atlas coach don vex.

95″ Fatima try to cross one ball into di Ghana area from di left but Ghana keeper Konlan comot wey she catch am.

93″ Freekick to Ghana. Di ball enta di Morocco box, bifor Chantelle try to use her body shield am and turn, but ref whistle say na offside.

Goalkick. One of di subs wey don enta di game now now, don kick her cross from di far right over di bar for goalkick to Ghana.

91″ Morocco don start from wia dem bin end for di first 90 mins, dem alreadi begin to attack Ghana. Di atlas Lionesses don make two changes.

Dis na di second time Ghana bin dey play extra time in four days afta dem bin win dia quarterfinal game on penalties afta extra time against Algeria.

Most of di second half na Morocco wey dominate wey dem bin create chances, but dem no fit score di goal to win di game for 90 minutes.

Ghana v Morocco

Wia dis foto come from, CAF WOMEN’S FOOTBALL

Wetin we call dis foto, Ghana and Morocco neva play competitive game; dis na di first time di teams go face each oda

Second Half

Referee don blow whistle for fulltime. Na extra time go decide dis game.

Morocco bin dey try to create one more chance. Dem bin dey pass pass di ball inside di Ghana area bifor dem take di ball go back to dia defender.

90+3″ Ghana try to attack. di ball no reach di target. But di black queens still try to press to win di ball.

90+2″ Ref blow whistle sake of head injury. Di medical team bin dey treat di two of dem.

Freekick to Morocco. Anoda dangerous one, dis time two players clash, Evelyb Badu and Yasmin Katie Mrabet as dem bin challenge for one high ball.

Dem bin add 5 minutes to di game. If none of di two teams find di winning goal, extra time go decide who go meet Nigeria for di final.

From di corner Ghana try to create one chance, di player shoot inside di box but di Morocco bodies plenty. Di follow up dey weak, na so Morocco collect di ball to attack.

88″ Corner to Ghana; bifor dem go play am, dia coach bin make one change, Evelyn Badu bin replace di goalscorer Stella Nyamekye.

87″ From di way dis game bin dey go now, whoever go score now fit win di game. Morocco so far still dey pepper di Ghana defense.

85″ Morocco bin dey want penalty afta striker Ibtissa Jraidi try to hit di ball on goal but she end up wit kick into di Ghana defender. Ref wave play on.

84″ Chebbak take di freekick, dangerous one but Ghana clear dia lines; but dem no get any outlet wey to carry di ball, e don go straight back to Morocco.

83″ Freekick to Morocco for anoda dangerous area in front of di Ghana area.

82″ Ghana try to attack afta one morocco counter attack down break down, but di final pass for di Morocco area na poor, Morocco regain possession.

Yellow card to Boye-hlorkah afta she foul her marker Sanaa Mssoudy. Afta dat foul ref bin wave advantage but dem bin foul anoda Morocco player.

79″ Wasted! Ghana bin waste di corner. Stella Nyamekye kick di corner to goalkick.

78″ Ghana no create any decent chance dis second half, na all one way traffic for Morocco bifor Adubea try to beat her marker Nouhaila Benzina for di far side. she bin win corner.

77″ Ref blow whistle for game to continue afta di VAR check, no pen.

75″ Freekick to Morocco. Dem play di ball inside di box but Ghana defend, but di ball still dey dangerous bifor Sanaa Mssoudy fall for ground. She bin dey want penalty. Na so VAR bin dey check if Josephine Bonsu bin foul her

74” Morocco get anoda chance to attack di Ghana area; captain Chebbak beat her marker wia she cut di ball for her teammate but Ghana block di shot.

73″ Di game don restart. Ghana win throw-in for dia area.

72″ Keeper don get up to kick di ball inside. But di Morocco captain clash wit Ghana midfielder Jennifer Cudjoe. clash of knees. Di two players dey for ground.

71″ Dis break go make Ghana catch dia breath sake of di last 5-10 minutes na all Morocco.

For di mean time di Ghana keeper also bin dey for ground. She don dey receive treatment.

70″ Anoda change for Ghana as Princella Adubea don enta di game to replace Doris Boaduwaa.

68″ Sakina Ouzraoui try enta di Ghana box again and again and again, dis time she don win corner.

Di freekick dey dangerous but Ghana bin clear am. Now di pressure all bin dey on top di Ghana players.

67″ Freekick to Morocco for di Ghana area afta dem foul Sanaa Mssoudy for di attack. Dangerous area.

65″ Morocco try one shot in front of di Ghana box but e dey weak. From di next attack Ghana win corner thru Boaduwaa, as she try enta di box. Nouhaila Benzina block her. Later di ref change di decision to goal-kick.

64″ Morocco bin dey rush tins now. Whenever dem get di ball, dem dey try rush to attack. Dem win freekick for di center.

63″ Ghana take di freekick but dem clear am bifor di ball fall for Comfort Yeboah; di defender strike di ball from distance but e neva dey on target.

61″ Ghana bin dey try to create sometin quickly but di attack don end wit one foul on Garce Asantewaa. Ref don give di Morocco captain yellow card for dat foul. Di fans for di stadium no gree.

60″ Yellow card for di Morocco coach Jorge Vilda as im bin dey protest for di touchline about one decision.

57″ Dem bin treat di Ghana keepr for few minutes bifor di game don restart. Ghana bin change Princess Marfo wey dem carry Alice Kusi enta di game.

Morocco

Wia dis foto come from, CAF WOMEN’S FOOTBALL

Wetin we call dis foto, Di Atlas Lionesses bin get di best attack so far wit 10 goals

54″ GOOOOOAAAAL! Morocco don score. Ghana defender Comfort Yeboah fail to clear one harmless ball, na so pressure come dey on top di Ghana defence wey Sakina Ouzraoui don take advantage to score. 1-1

For di last 20 seconds Ghana don dey ballon dia balls into di Morocco area; wey dey give di Atlas Lionesses chance to score.

53″ Wasted! Sanaa Mssoudy don waste di cornerkick, she bin play di ball ova di Ghana net.

52″ Morocco now bin dey put pressure upon pressure for di Black queens backline. Dem don win anoda corner.

50″ CHAAAAAANCE! Morocco tink say dem score, substitute wey dey wear number 10 jersey try to bend one ball for di far corner but goalkeeoer Konlana stretch wey she save di ball.

49″ Chance for Ghana, Comfort Yeboah beat her marker wey she carry ball enta di Morocco area, her cross dey too deep na so di ball go too far for any proper Ghana connection.

48″ Morocco try to create chance for diaserf; dem lift di ball for di Ghana box, Ouzraoui try to meet it but goalkeeper Cynthia Konlan don comot wey she catch am.

46″ CHAAAANCE! Ghana nearly score di second goal after one mistake from di Morocco keeper Khadija Er-Rmichi. She bin delay to clear one ball wey Doris Boaduwaa pressure her; di ball now fall for Stella Nyamekye but her chip ova di keeper go ova di bar.

45″ Morocco bin dey try very early to get dia goal.

Players don comot for di second half.

First Half

ghana

Wia dis foto come from, CAF WOMEN’S FOOTBALL

Wetin we call dis foto, Ghana bin reach dis stage for di Wafcon for di first time since 2016

For di Atlas Lionesses, dem go vex say dem no take advantage of even one of dia chances.

Di black queens enta di break wit 1-0 lead, even tho dem fit to score two more goals, if like dem be clinical for di Morocco box.

Di Morocco captain Ghizlane Chebbak no happy say referee don blow for halftime.

45+2″ Afta di corner, Morocco bin get anoda corner but bifor dem go even play am, ref whistle for halftime

45+1″ Morocco captain Chebbak enta di box wey she try to meet one pass from Mssoudy but she fall for ground afta Ghana bin clear di ball. she bin dey ask for penalty but ref say corner.

Sakina Ouzraoui bin dey give di Ghana defenders pressure for dia left hand side wit her speed and footwork, but once again, Grace Asantewaa don stop her.

44″ Chance! Ghana bin try to score di second goal from one attack but Stella Nyamekye don fall for ground, She tink say na penalty but ref blow whistle for goalkick.

First yellow card to Sanaa Mssoudy as she bin trip Grace Asantewaa from di back.

41″ Sakina Ouzraoui don foul Grace Asantewaa as she try to turn andset counter attack.

As di half time don dey approach, both teams dey try to take control of di ball.

40″ Morocco forward Sakina Ouzraoui dey do some fine footwork to beat Josephine bonsu for di right side.

39″ Black queens defender don hold di ball wia she beat two players bifor she pass to Princess Marfo, but dem bin foul her.

Di Morocco captain dey try create sometime out of notin for hia. she reach di edge of di Ghana box, wey she try to bend one shot to di top corner but di ball always dey rise.

37″ Chaaaance! Anoda miss by Boaduwaa. Her shot dey wayward. Ghana try to score from counter attack.

Ghana bin take anoda freekick for di edge of di Morocco box, dis time na poor kick, wey di Atlas Lionesses don clear.

36″ Morocco don change one player, dia number 10 player don enta pitch.

34″ Chaaance! Ghana don miss ogbonge chance, Hlorkah bin put one low cross into di middle of di box to Doris Boaduwaa, she don flick di ball ova to Princess Marfo, but her shor wit di outside of her boot dey wide.

33″ Di freekick from Asantewaa into di box dey dangerous but nobody fit attack am, na so Morocco captain Chebbak defend wia she clear di ball away.

32″ Freekick to Ghana for di edge of di Morocco box afta dem foul di goal scorer Stella Nyamekye. chance for di black queens.

31″ Sekina Ouzraoui bin dey try one back-heel to pass di ball to her teammate but Ghana collect wia dem try to attack.

29″ Ghana try to create anoda chance but di cutback from di black queens player inside di Morocco box dey weak.

28″ From di restart Morocco drive dey enta di Ghana area to score but di striker hold di ball too long instead say she go shoot on goal, na so di chance don vanish.

morocco

Wia dis foto come from, CAF WOMEN’S FOOTBALL

Wetin we call dis foto, Di hosts wan repeat wetin dem do for di 2023 edition when dem reach di finals

27″ Dat na di first real chance for Ghana so far for di game wia dem take advantage.

GOOAAAAAL! Ghana bin score from di follow up afta di corner kick. Stella Nyamekye don tap di ball ova di line afta Josephine bonsu bin head di ball on target.

24″ Corner to Ghana afta one small nixup inside di Morocco box; ghana bin put pressure for di Atlas lionesses for di last few seconds. Dem fit use dis corner for anitin?

23″ Morocco try anoda dangerous attack but Ghana captain Portia Boakye bin cut di thru ball.

22″ Foul. Freekick to Ghana afta Yasmin Katie Mrabet bin foul Ghana midfielder

Chaaaance! Morocco bin dey get di half chances so far, anoda one from di counter wit anaa Mssoudy and Ibtissam Jraidi but di final shot dey wide off di Ghana post.

20″ Di Morocco winger bin dey try to beat di Ghana defenders for di far side, she enta di box, but as Sanaa Mssoudy try to cross di ball, e don hit one Ghana defender wey di chance spoil.

19″ Di fouls don plenti for dis opening 20 minutes of di game.

18″ Morocco dey still try di ball ova di top for striker Ibtissam Jraidi. But di Ghana defence dey alert everitime so far.

17″ Everitime di ref decision don go against di hosts, dia fans bin dey scream for di stadium.

Ghana player Comfort Yeboah don land awkwardly for ground afta one tackle from Sanaa Mssoudy.

15″ Ref don whistle for foul against Morocco captain Chebbak as she bin dey hold di shirt of her opponent. Di fans for di stadium bin dey roar against di decision.

14″ Morocco bin win throw0in for di Ghana left hand area, afta Asantewaa don block one cross. From di throw-in Morocco carry di ball go back to midfield.

Afta dat chance, Princess Marfo also try anoda weak shot from outside di box wey neva trouble di keeper.

13″ Chance! Stella Nyamekye don try one shot from di left hand side of di Morocco area but keeper Khadija Er-Rmichi don save am simple.

10″ Alredi di two coaches don make wild on top di touchline, di game neva even reach 15 minutes yet

9″ Be like di ball don dey stick under di feet of di players, everitin dem bin dey try to do so far neva dey work.

Ghana don dey struggle to keep dia passes togeda for di last one minute, bit di game don even out now.

7″ Morocco dey try to go behind di Ghana defence but dia final balls bin dey lack purpose.

Foul! Princess Marfo don trip di Morocco captain Chebbak for di touchline.

5″ Ghana tink say dem bin win throw-in for di Morocco half but ref tok say na against Ghana.

4″ Ref don restart di game wit dropball; Morocco don try to possess di ball bifor Ghana collect for dia hands and try to enta di box, di Morocco keeper Khadija Er-Rmichi don catch di ball.

3″ Di Ghana captain bin dey receive treatment formdi center area; dat tackle don enta her stomach.

2″ Ghana captain Portia Boakye bin fall for ground afta one high foot tackle from her own player Josephine Bonsu.

1″ Early seconds for di game, di passes no dey click so far but di teams dey try take any early advantage dem go fit find

Morocco don pass di ball to begin dis ogbonge match.

Ref don blow whistle wey di game don start.

Ghana bin dey wear dia yellow jersey once again – wey host nation Morocco bin dey wear dia red jersey.

Once again welcome everibodi. Both teams don comot for di pitch now.

ghana

Wia dis foto come from, GHANA WOMEN’S FOOTBALL TEAM

Wetin we call dis foto, Ghana coach sabi say di game go hard but im say di girls go exploit di weakness of di host team

Dis na di lineup for di two teams

Ghana XI: Cynthia Konlan (GK); Susan Duah, Grace Asantewaa, Jennifer Cudjoe, Princess Marfo, Chantelle boye-Hlorkah, Doris Boaduwaa, Stella Nyamekye, Comfort Yeboah, Portia Boakye ©, Josephine Bonsu.

Morocco XI: Khadija Er-Rmichi (GK); Zanmeb Redouani, Nouhaila Benzina, Elodie Nakkach, Ghizlane Chebbak ©, Ibtissam Jraidi, Aziza Rabbah, Hanane Ait El Haj, Sanaa Mssoudy, Sakina Ouzraoui, Yasmin Kate Mrabet

Latest news
Related news