16.9 C
London
Wednesday, July 23, 2025

Security officers block Senator Natasha Akpoti-Uduaghan from entering National Assembly building

Natasha Akpoti-Uduaghan is a Nigerian female senator Natasha Akpoti-Uduaghan is a Nigerian female senator

Nigerian female senator wey bin raise allegations of sexual harassment against di senate president, don dey denied entry into di National Assembly building for Abuja dis Monday.

Di senate bin suspend Senator Natasha Akpoti-Uduaghan for six months for March dis year afta dem find her guilty of flouting dia standing rules, but on 5 July, 2025, di federal high court for Abuja rule say di senate “can and should recall her”.

Di senate spokesperson, Yemi Adaramodu, bin don tok say di ruling no be binding order but na mere advisory to di senate leadership wey dem fit obey or not.

But Akpoti-Uduaghan bin tell her supporters say she go resume for di senate chambers on Tuesday in accordance wit di court ruling.

Security presence for di entrance of di National Assembly complex bin dey tighter on Tuesday in anticipation say di senator fit show up, and she true-true try to gain access into di complex but dem deny her entry.

Dem first stop her vehicle for di outermost gate, but di senator come down and waka pass di first barricade wia another batch of security personnel stop her again.

Latest news
Related news