Di US Mision for Nigeria don drop anoda update wey concern visa
Di United States Mission for Nigeria don drop anoda update for Nigerians and oda pipo wey dey try enta dia kontri or already dey dia.
Dem say dia interagency efforts dey combat fraud and go end illegal immigration.
For one statement for dia social media handle, U.S. tok say dem go ban anybody wey commit visa fraud from di United States for life.
Dis statement na di latest development for di United States clamp down on illegal migration.
“A nation without borders no be nation”, di US mission further tok.
Wit promise say dem go pursue criminal charges against those wey involve in visa fraud and those wey dey bring in and harbour illegal aliens.
Exactly one week ago, di United States bin send one strong reminder give foreigners wey dey plan or already dey di kontri say make dem no overstay dia visa or di time wey immigration give dem to stay.
U.S. Embassy tok say anybodi wey stay pass di allowed time wey dem give am for America fit face serious wahala.
Recently, di United States Mission for Nigeria bin don announce say dem go sweep changes to dia non-immigrant visa policy for Nigeria, wey reduce di duration and conditions under which most Nigerian travellers go fit enta America.
Documents wey fit count as fake for U.S. visa application
To commit fraud or lie fit cause serious wahala for U.S. immigration matter wey include visa denials, deportation, and lifetime bans from entering di U.S.
Immigration officials dey take lies seriously, and even small misstatements fit lead to serious penalties.
Dis na list of tins wey fit attract legal consequences for immigration proccess.
Under U.S. immigration law, fraud and misrepresentation na wen pesin provide false informate or withhold important details so e go fit get immigration benefit.
One section of di U.S. immigration policy tok say any foreign national wey “by fraud or willfully misrepresent a material fact seeks to procure (or dey try to procure or don procure) visa, oda documentation, or admission into di United States or oda benefit” dey permanently inadmissible.
Anoda section tok say anypesin wey make false claim to be U.S. citizen for any immigration benefit or oda purposes fit also lead to permanent ban.
Examples
.To lie on visa application like wen pesin provide false employment history.
.To use fake marriage collect green card.
.To submit forged documents, like fake bank statements and odas.
.No disclose previous visa denial.
.Misrepresent intention – wetin dis one mean na say if pesin enter on tourist visa but get intention to stay permanently.
According to di U.S. mission Nigeria statement, dis kain tins wey we list above fit cause key penalties wey include:
Permanent Ban: Wetin dis one mean be say pesin wey di U.S. sama permanent ban no fit obtain visa, green card, or enta di U.S. unless America grant am waiver.
Visa and Green Card Denials: U.S. Citizenship and Immigration Services (USCIS) and di Department of State (DOS) dey review applications for fraud. If dem detect any kind of fraud, di application go dey denied.
Removal (Deportation)
Any pesin U.S. and is found to have committed fraud or misrepresentation, fit dey placed for deportation proceedings.
Criminal Charges
For some cases, immigration fraud fit lead to criminal prosecution wey cover fraudulent immigration documents. Convictions fit result in fines and imprisonment.