Patients dey advised to remove metal items bifor dem go near MRI machine
One 61-year-old man don die afta di Magnetic Resonance Imaging (MRI) machine, suck am in, inside one medical centre while im wear one heavy metal necklace.
Nassau County Police Department say di man wey dem neva identify yet, bin enta one room for Nassau Open MRI in Westbury, for New York Long Island, without permission, to wia di MRI machine wey bin dey run.
One patient for di facility tell local media say her husband na di pesin wey die. She say she bin call am to come inside di room afta she do scan on Wednesday.
Officials say di incident “result into a medical episode” and di man, dem take am to hospital, wia im die on Thursday. MRI machines dey use a strong magnetic field to produce ogbonge images.
Normally, dem dey tell patients to remove metal items and change dia clothes bifor dem do MRI scans or go near di machine.
“Di male victim bin wear one large metallic chain around im neck wey make di machine to draw am inside, dis tin result to medical episode,” na wetin Nassau County Police Department, wey investigate di incident tok.
Although police neva name di victim, Adrienne Jones-McAllister tell local television station News 12 Long Island say di pesin wey die na her husband, Keith.
“Im wave me goodbye and den im whole body go limp,” she cry as she tok am.
Madam Jones-McAllister tell tori pipo say she bin dey do MRI for her knee and she ask her husband to come inside to help her get up afta she finish. She say im bin wear one 20lb (9kg) chain wit one lock wey im dey use for weight training.
“At dat instant, di machine switch am around, pull am in, and im hit di MRI,” she tok.
Madam Jones-McAllister say di technician bin try to pull her husband comot from di machine.
“I bin dey tok say, ‘you fit turn off di machine?” she tell di outlet. “Call 911. Do something. Turn dis damn thing off!'”
BBC bin contact Nassau Open MRI for comment.
According to di US Food and Drug Administration, MRI machines get magnetic fields wey fit attract magnetic objects of all sizes – keys, mobile phones and even oxygen tanks – wey “fit cause damage to di scanner or injury to di patient or medical professionals if those objects become projectiles”.
For 2001, one six-year-old boy bin die from fractured skull for one New York City medical centre while im dey do MRI exam afta di powerful magnetic force for di machine move one oxygen tank across di room.