Buhari die for one London Hospital on Sunday 12 July, 2025
All roads go lead to di village of Daura for Katsina State wia di bodi of late President Muhammadu Buhari go dey laid to rest dis Tuesday.
Wetin many bin tink say go be simple burial for di 82-year old statesman wey rule Nigeria for two different times, go now be grand state affair.
Buhari die for one London Hospital on Sunday 12 July, 2025 from sickness wey neva dey disclosed.
President Bola Ahmed Tinubu on Monday set up ogbonge committee wey di chairman na di Secretary to di Govment of di Federation George Akume, plus oda top-top govment oga dem to handle di event.
Tinubu imsef and oda leaders across Africa dey expected to be present for di burial wey go happen dis afternoon. Govment don also declare Tuesday a public holiday for Nigeria in honour of di late Buhari.
BBC Pidgin go bring you updates of di event as e dey go on, but for di meantime, hia na evritin you suppose know about di burial of Buhari, a man wey even im critics agree say na honest leader.
Time for di burial
Di funeral events proper go start by 14:00 GMT or 2:00 PM Nigerian time, for Buhari hometown Daura, in Daura Local Govment Area, Katsina State.
Guvnor of di State Dikko Radda say di bodi of di late President go leave London by 6:00am dis Tuesday and dem expect am to arrive for Katsina at around noon.
Already, Vice President Kashim Shettima bin lead a govment delegation wey President Tinubu bin direct to go and accompany Buhari remains from London bak to Nigeria.
Di team arrive for London on Monday morning.
Tinubu go receive di bodi
President Bola Tinubu go receive di body of Muhammadu Buhari for di Katsina Umaru Musa Yar’adua Airport for Katsina, wia a state funeral ceremony go take place bifor dem go take am to Daura, less dan 100 kilometres from Katsina City, for burial, according to di Minister of Information, Mohammed Idris.
Aside fro declaring dis Tuesday as a public holiday for di kontri, President Tinubu don also declare seven days of national mourning.
E also shift di weekly Federal Executive Council (FEC) Meeting wey bin suppose hold on Wednesday, to Friday 18 July, to accomodate di burial date.
Special committee for di burial
Di high-power committee wey Tinubu setu up do handle di funeral arrangements for di late former President Buhari go dey chaired by George Akume, di Secretary to di Goment of di Federation, while di Permanent Secretary, General Services Office, go serve as di secretary.
Oda members include:
.Minister of Finance and Coordinating
.Minister of the Economy
.Minister of Budget and Economic Planning
.Minister of Defence
.Minister of Information and National Orientation
.Minister of Works
.Minister of Interior
.Minister of di Federal Capital Territory
Minister of Housing and Urban Development
.Minister of State for Health and Social Welfare
Minister of Art, Culture and Creative Economy
.National Security Adviser
.Special Adviser to di President on Policy and Coordination
.Senior Special Assistant to di President on Political and oda Matters
.Inspector-General of Police
.Director-General of the Department of State Services
.Chief of Defence Staff
.He stated that the Office of the will serve as the Secretary to the committee.