Wia dis foto come from, GHANA WOMEN’S NATIONAL TEAMS/TANZANIA FOOTBALL FEDERATION/FACEBOOK
Di final group C game for di ongoing Wafcon between Ghana and Tanzania go happun on Monday night.
Na do-or-die match; di winner go fit qualify for di quarterfinal of di tournament sake of di two teams gat one point each from dia first two games.
Both teams sabi say dem no fit do mistake for dis ogbonge game, sake of defending champions South Africa already bin qualify afta 2 wins from 2 games, and dem go play against Mali for di oda group C match.
Di black queens so far dey struggle to score goals afta dem bin score only one goal from 31 shots for dia two games.
Di twiga stars of Tanzania also bin score only one goal from dia two group games.
But for dis match, di two coaches go put tactics for ground and hope say dem go find di luck wey go help dem score goals.
If both teams play anoda draw today, dem go pack dia bags and comot di tournament.
For di black queens – dem bin lose 2-0 to defending champions Banyana Banyana wia dem draw 1-1 wit di female eagles of Mali for di second game.
Na so di twiga stars of Tanzania lose dia first game 1-0 to Mali wia dem draw 1-1 wit South Africa for di second match.
Dem score first thru Opa Clement Tukumbuke for di first half bifor South Africa bin equalise afta di 70th minute.
Wia dis foto come from, TANZANIA FOOTBALL FEDERATION/FACEBOOK
Wetin di two coaches tok
Wia dis foto come from, GHANA WOMEN’S NATIONAL TEAM/FACEBOOK
Head coach for di Twiga stars Bakari Shime believe say im team fit build on dia 1-1 draw wit defending champions South Africa, for dis game against di black queens.
“From di way we play dat match, e don give us confidence,” oga Shime tok wey CAF online don quote.
Shime also bin get im goalscorer Opa Clement Tukumbuke available for di game; im believe say she fit lead her girls to victory.
“We to play dis last group game, na very important game for both teams but for us especially.”
Im add say “we gat one point so far wey we dey look forward to get 3 points wey go make us qualify for di next round.”
“We sabi Ghana well well, we don follow dia two games; but we wan walk away wit 3 points, we wan go forward, na so we go try to achieve our aim,” Bakari Shime tok for pre-match press conference.
For di black queens coach Kim Lars Björkegren, to comot di Wafcon for di group stage na shame.
Im tok say im go keep to dia plan for dis game.
“We gat everitin for our hands to win dis game v Tanzania. We bin dey hope to score more goals for our first two games, we gat di chances but we no fit do am.”
Im add say “I sabi say we dey good position, we for only win one game to play for di quarterfinal, we fit be second or third for di group, I still believe in our players.
Back home, football fans and sabi pipo believe say coach Björkegren no deliver so far for di tournament, wey dem dey fear say Tanzania go comot Ghana.
But di players say dem go try to make di fans proud for dis one.
Wia dis foto come from, GHANA WOMEN’S NATIONAL TEAM/FACEBOOK
Head-to-head
Dis Monday game na di first time Ghana and Tanzania bin dey face each oda.
Both teams don score one goal for di Wafcon dis year, na only Tunisia and Botswana (0) no score any goal at all.
Ghana neva get clean sheet for dia last 7 games
Tanzania na di second lowest ranked team for dis tournament ; dem bin dey 137th for di FIFA women’s ranking wey Ghana bin Dey 66th.
For dia last five Wafcon, Ghana don only progress from di group stage for 2016 when dem bin finish third but dem don comot for group for 2008, 2010, 2014 and 2018.
Di Twiga stars bin qualify for di Wafcon only two times, di first for 2010 and then dis current edition.
For 2010, dem bin comot for di group stage.
Dis na chance to progress from di group stage for di first time.
Tins don set between di two for dis ogbonge clash for Monday night.
Wia dis foto come from, TANZANIA FOOTBALL FEDERATION/FACEBOOK
For Ghana, di coach go dey without striker Doris Boaduwaa wey bin assist di only goal for di black queens for di competition.
She don play 180 minutes for competition but di coach go hope say oda players like Princess Marfo go fit cause wahala for di left wing of di Twiga stars.
Princella Adubea wey be striker go replace Dori Boaduwaa as di target pesin.
Adubea fit hold di ball well well wey she fit play as di arrow head for di Ghana attack for dis game.
Midfielder Jennifer Cudjoe wey bin win woman of di match award v Mali also go start for di center, she go dey key for di Ghana coach.
Wia dis foto come from, GHANA WOMEN’S FOOTBALL TEAM/FACEBOOK
For di Twiga stars, dia captain Opa Clement Tukumbuke wey bin score dia goal v South Africa, go dey available to lead.
Coach Bakari Shime hope say she go lead from di front togeda wit star player Clara Luvanga.
Luvanga bin dey treat one ankle injury but she come back for dis game.
Di Al-Nassr player wey emerge from di Tanzania U17, U20 ranks fit make her debut for di game.
Di game go happun at 7PM GM (8PM WAT) for di Berkane stadium.
Make una dey wit us for di live text commentary for di ogbonge game.
At di same time, South Africa and Mali go play each oda.