15.3 C
London
Friday, July 4, 2025

Liverpool star Diogo Jota don die aged 28

Liverpool star Diogo Jota don die at di age of 28 years Liverpool star Diogo Jota don die at di age of 28 years

Liverpool star Diogo Jota don die at di age of 28 years.

Tori be say di Portugese winger involve for accident for Zamora, Spain.

Local media Marca report say di accident occur for A52 road, near di municipality of Palacios de Sanabria.

Jota dey inside motor wit im broda Andre wen dia car clear comot for road.

Diogo Jota broda wey be 26 years old, na professional footballer too, wey dey play for Portuguese second-tier club Penafiel.

Guardia Civil tell BBC Sport say Jota and im broda die around 00:30 local time on Thursday.

Dem tok say dia car, Lamborghini, comot for road becos tyre burst as dem dey overtake anoda motor, and di car catch fire.

Jota marry im long-time partner Rute Cardoso, wey dem don get three children togeda, just last month.

E recently post pictures for social media, from di ceremony wey happun on 22 June.

Jota help Liverpool win Premier League title last season and e play for Portugal as dem beat Spain for di final of Nations League for June.

“Portuguese Football Federation (FPT) and all of Portuguese football dey completely devastated” Pedro Proenca, head of FPT tok.

“More dan just bin amazing player, wit almost 50 international appearances, Diogo Jota na extraordinary person, wey all team-mates and opponents respect, person wey get infectious joy and na reference for di community.”

Diogo Jota profile

Dem born Diogo Jota for 4th December 1996. E be Portuguese professional footballer wey play as forward or left winger for Premier League club Liverpool and Portugal national team. Jota sabi score well, e get speed and e sabi dribble.

Jota start im career wit Paços de Ferreira, before e sign for La Liga club Atlético Madrid for 2016.

Afta two seasons for Primeira Liga, dem loan am go Primeira Liga club FC Porto for 2016 and EFL Championship club Wolverhampton Wanderers for 2017.

E help dem promote to Premier League, and e join di club for 2017 for €14 million. E play 131 matches for dem, score 44 goals. For 2020, e sign for Liverpool for £41 million.

E make im senior international debut for November 2019.

Diogo Jota don win four trophies wit Liverpool: one Premier League title, one FA Cup, one League Cup, and one UEFA Nations League title.

E win Premier League for 2024-2025 season. E win FA Cup and League Cup for 2022. E also follow Portugal team win UEFA Nations League for 2019 and 2025.

Jota die for car accident for Zamora, Spain, on 3 July 2025.

Latest news
Related news