Prime Minister of Israel, Benjamin Netanyahu
US President Donald Trump say ceasefire between Israel and Iran now “don dey in effect” and tell both countries: “Please no violate am!”.
Several hours after Trump announcement, di Israeli government also confam am and agree to di ceasefire, and warn say dem go “respond forcefully to any violation”.
Iran earlier bin say dem go only stop dia attacks if Israel do di same.
Dis dey hapun after Iran launch missiles for US airbase in response to strikes on im nuclear sites over di weekend – Qatar say dem stop all di missiles.
Iran state TV news channel IRINN say ceasefire don dey “imposed” on Israel following di “successful” Iranian attack on di US base for Qatar.
State TV tok for statement say Trump “beg” for a ceasefire afta Iran attack. Presenter read di statement loud.
Di statement also hail Iran Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) and di Army and praise di “resistance” of Iranians.
Wetin we know about di Iran-Israel ceasefire
.Na just afta 23:00 BST yesterday, Donald Trump announce say Iran and Israel don agree to ceasefire
.By 06:08 BST, Trump officially declare say di ceasefire dey in effect
.Around 07:10 BST, Israel say dem don agree to di US ceasefire proposal
.Iran bin say dem go stop attacking if Israel do di same last night
.Before di ceasefire take effect, both countries exchange heavy fire overnight
.E never still clear how many die or injure for Iran, but Tehran don get one of im worst nights, according to our reporter
.Israel say at least four people die and 22 injure for di southern town of Beersheba
More from Israel statement on di ceasefire
Di Israeli government say dem agree to di ceasefire proposal after “dem achieve di objectives” of im attacks on Iran.
According to di statement, Israel don remove Iran “dual immediate existential threat” from nuclear weapons and ballistic missiles.
E also say Israel don “inflicted serious damage on di military leadership, and destroy dozens of central Iranian government targets”.
Di statement go on to say Israeli forces, in di last day, don “seriously strike government targets in di heart of Tehran, eliminating hundreds of Basij operatives” – one militia wey di Iranian government dey often use to suppress protests – and “eliminate anoda senior nuclear scientist”.
“Israel thank President Trump and di United States for dia support in defence and dia participation in eliminating di Iranian nuclear threat,” di statement add.