19.9 C
London
Friday, June 6, 2025

Eight wound afta man set pipo on fire for Colorado rally for Israeli hostages

Eight pipo don wunjure afte one man throw fire bomb wia pipo gada for Boulder, Colorado Eight pipo don wunjure afte one man throw fire bomb wia pipo gada for Boulder, Colorado

Eight pipo don wunjure afte one man throw fire bomb wia pipo gada for Boulder, Colorado.

Di pipo bin gather to demonstrate in remembrance of di Israeli hostages wey still dey for Gaza, authorities tok.

But one 45-year-old man wey shout ‘Free Palestine’ just throw fire bomb inside di gathering. Dem don identify di man as Mohamed Soliman from Egypt.

Boulder Police Chief Stephen Redfearn say many pipo wunjure for di incident, including injuries like burns and odas.

Redfearn say police find di suspect and take am to custody “without incident” – dem also carry di suspect go hospital wit minor injuries, di police chief tok.

Israel foreign minister, Gideon Sa’ar, for im statement say e dey “shocked” by di incident and call di attack “pure antisemitism”.

“Shocked by di terrible antisemitic terror attack targeting Jews for Boulder, Colorado,” e write on X.

“Dis na pure Antisemitism, fueled by di blood libels wey dey spread for media. I tok wit our Ambassador for di US and our Consul General for LA.”

Homeland Security Secretary Kristi Noem say di her department dey work wit “interagency partners, including di FBI”, on di mata.

Di FBI for press conference say dem dey treat di attack as a suspected act of terrorism.

FBI special agent Mark Michalek say di victims dey between age 67 and 88.

In 2022, Soliman enta California on a non-immigrant visa wey expire in February 2023, multiple sources don tell CBS News. E neva tey wey e begin live for Colorado Springs.

According to di FBI, di suspect shout “free Palestine” as e carry out di attack as e use a “makeshift flamethrower” and a “fire bomb device”.

We dey update dis tori

Latest news
Related news