Foto of Jumoke George during one of her birthday celebration
Popular Nollywood actress, Jumoke George, don tok say na inside church she dey live for about six years now.
Jumoke George for one strong emotional interview wit fellow actress Biola Adebayo on how she begin live for church six years ago, battle wit illness and a missing 41-year-old daughter.
Anchor and di owner of TalkToB show, Biola Adebayo bin ask Jumoke George why she bin hide her problem and she respond say na sake of shame and fear say di public go mock her.
Di ogbonge actress further explain say na early 2025 her health gbege bin start and sake of dat, she need cancel acting jobs wey she don kollet.
“Sometins dey wey dey embarrassing to tok but at dis point, I no get choice. I wan speak out. I dey work but no be like say I dey get jobs every time.
“Sometimes, e fit be once in three to four months. Dat na bifor I become ill. Afta I become ill, I bin no fit go for set wey I dey invited to.”
Jumoke George also tok how pesin bin pay am since 2024 and she later spend di moni to treat herself afta she fall sick.
“I bin go anoda location but I no dey able to work. Dey bin bring me back sake of my health. I don do several tests. Dem do some more wey go cost about 400,000. I no know wia to get di money from.”
‘How I begin live inside church’
Jumoke George further narrate how she begin live inside church for about six years afta landlord evict her from her apartment sake of she no fit afford rent.
“Di house rent become high and I no fit afford am anymore. Di landlord bin tell me to leave, I beg but e no gree but wetin I wan do?”.
Na afta den di church leader bin give her one small space to dey stay and she even keep di place as secret pipo sake of embarrassment.
“Daddy bin tell me to bring my tins to a place wey e get for me but e too small, and no even contain my tins, so I need to put my luggage wit different pipo. Di tins wey I work for all my life just dey spoil.
“Everibodi for church get access to di room. I only dey welcome guests inside daddy living room downstairs wia dem dey hold events like harvest.
She den point one space wia she dey put her mattress to sleep.
Jumoke George say di ‘daddy’ wey bin giver her space for di church two years ago die and na di ‘mummy’ of di church dey feed her most times.
“She dey buy drug for me and boil herbs for me”.
‘My 41-year-old daughter dey miss for four years now’
Jumoke George problem no end for her health issue and her homelessness, she also narrate how her first child wey be 41-year old dey miss since di past four years.
“My first child, Adeola, dey missing. I don dey look for her for di past four years. Any small money I get from work I dey spend to look for her”.
“She dey Ibadan wia she dey work and live wit my mama. So my mama just called me one day say she no see Deola wey say she dey come meet me for Lagos. I bin tok say I neva see her,” di actress tok.
Na later wey 41-year-old Adeola call one day to beg for forgiveness and say she don migrate wit some friends to go find better life but wetin she see dey different from wetin dey bin tell dem.
“Since den, I never hear anytin from her. I be di one wey dey take care of her children sake of say I no see di papa of di children since dey separate wen di children bin dey younger”.
“I no get im number, I no know im town, I no sabi wia to find am. She dey born for 1984, she bin clock 41 on May 1, dis year. If to say she dey here, at least we go dey manage togeda.”
She also tok about her son, Ife, wey don borrow close to Two million naira for her hospital bills and oda expenses.
“Ife, also dey assist me. E don try. I don put am in so much debt, she tok.
Di actress say her son Ife salary small but e dey try to take care of her. And e also dey search seriously for im sister.
“I don tire. I don try my best as a believer. Even wit my ill health, I don dey fast and pray. I no understand again, whether na spiritual or not, di actress tok as she kontinu dey cry.
She beg di public make dem help her out of di wahala.