Cristiano Ronaldo and im son dey play for Al-Nassr
Portugal don call up Cristiano Ronaldo eldest son for dia Under-15 squad for di first time.
Di 14-year-old Cristiano Ronaldo Jr dey play for Al-Nassr for Saudi Arabia wit im father, wey bin sign for di Pro League club for December 2022.
Portugal great Ronaldo, 40, post picture for social media of im son name for di national team squad list wit dis message, “Proud of you, son”.
Ronaldo Jr dey part of di squad wey dem select for one youth tournament, for Croatia between 13-18 May, Portugal go play Japan, Greece and England.
Five-time Ballon d’Or winner Ronaldo Sr still dey play Portugal and im don score 136 goals for im kontri – wey be world record for men football.
Di 40-year-old bin captain Portugal to dia first major title for Euro 2016, although im bin watch di majority of di final from bench sake of injury wey im get for 25th-minute.
Ronaldo bin also lead im national side to di Nations League title for 2019.
For March, Ronaldo bin score but miss penalty as Portugal beat Denmark to reach di Nations League semi-finals.
Di ex-Manchester United forward get four oda children – twins Eva and Mateo, 7, Alana Martina, 7, and Bella, 3.
Ronaldo Jr career so far
Ronaldo Jr dey follow im father football career, im play for Real Madrid, Juventus, Manchester United and Al-Nassr academy, as im father bin dey play for di first team.
Tori be say im bin score 58 goals for one season during wen im bin dey play for Italian giants Juventus.
Im don play alongside Wayne Rooney son, Kai, for di youth set-up for Manchester United wen Ronaldo Sr bin return for a second time for Old Trafford.
Videos of di teenager wia im do Ronaldo Sr iconic ‘Siu’ celebration bin go viral while im dey play for Al-Nassr.
Even though Portugal don invite am for di under-15 side for next month tournament, Ronaldo Jr also dey eligible to play for di kontri wey dem born am – United States – or Spain due to residency wen im father play for Real Madrid.