11.6 C
London
Thursday, May 1, 2025

PDP don lose dia stronghold for Nigeria?

Wit Sheriff Oborevwori now inside di All Progressives Congress (APC), di colours on di political map of di South South don change.

Oborevwori, di Delta state govnor officially dump di party wey bring am into power, Peoples Democratic Party (PDP) to jump inside APC on Monday.

Tori of im defection bin first spread afta video circulate for social media wia di govnor and im cabinet members declare support for Tinubu wit popular song wey dey linked to am.

Di ordinary believe na say di Delta state govnor defect into di ruling party just to secure im political future.

Im defection don give APC, three out of di six South-South states wey be traditional stronghold of di PDP for more dan 20 year.

Di three states for di region wey dey under APC rule na Cross River, Edo and Delta while Rivers, Akwa-Ibom and Bayelsa still dey under PDP control.

Tori don also begin spread say two more PDP-controlled states go soon enta APC hand.

And all dis na for di 2027 election and beyond.

“Of course e dey obvious say di PDP don lose plenty ground for Nigeria. Check how many states dem bin dey control for 2015 and how many states dem dey control now,” Lekan Ige, ogbonge political sabi pesin, tell BBC Pidgin.

“PDP bin dey in charge of 11 states but as di Delta State govnor don comot now, dem just dey in charge of 10. And rumours still dey fly say di govnors of Akwa Ibom and Rivers State fit still comot to join APC.

“At a time for dis kontri, di PDP bin dey control di executive arm of goment and di national assembly, today dem be opposition. So e dey clear say dem don lose plenty ground and popularity,” Oga Ige tok.

Nigeria risk becoming one party state

As PDP dey collect big blow sake of di current pollical scene wia many of im members dey run go di ruling party APC, some analysts say di reasons why some pesin dey defect go anoda party, especially di ruling party na to hide dia bad records, so dem go fit hide under di party.

Howeva, di concern now be say dis defection fit lead Nigeria to enta one party system wey be say opposition no go even dey again.

Akinola Ayobami wey be political analyst say one party system na trend wey dey worry di current Nigeria politics.

E say dis one-party system na political structure wia one single party go just dominate di govment and even no room go dey for opposition or oda voices.

“Sake of di current political landscape, e be like Nigeria dey move towards a one-party system. Di current president don previously show dis style of governance wen im be Govnor of Lagos state, and e be like say e wan do same tin for di federal level.”

Just like odas, Ayobami worry say one party system for Nigeria go just give single control ova di three arms of govment and opposition no go fit speak up wen matter dey go wrong.

In recent times, we don see Senators and House of Representatives members for Nigeria dey defect from di PDP to di APC, and di move dey point to one direction say dem dey chook eyes for di 2027 general elections.

“Di recent trends of defection between di PDP and di APC for Nigeria dey expose di kontri politics, as e be like say political parties and politicians dey about self-interest and to pursue power instead of commitment to public service.

Di analyst point am out say politicians wey dey put personal gain first, go dey use state resources for dia own benefit, instead of make dem ‘deliver public goods and services.’

Many pipo dey worry say if Nigeria enta one party system, e mean say checks and balances no go dey again for govment as e be say na one party dey control dem.

Howeva, even though one party system don dey successful for some kontri sake of strong leadership and integrity, analysts say di result for Nigeria fit end in disaster.

“Di lack of accountability and transparency go lead to further corruption and mismanagement of resources, wey go end for poverty and inequality. Di implications of dis trend dey serious, and e include lack of vision and direction, and di risk of a one-party system.

“To avoid dis risks, Nigeria politicians need to prioritize di public good ova personal interests and work to build a more accountable and transparent democracy,” Akinola add.

But Oga Ige no believe say APC go swallow di oda opposition parties sotay Nigeria go become one-party.

“I no tink say e dey possible. Wetin dey happen now no be new tin so to say. Na normal tin wey dey usually happen wen election season don dey around di corner,” Ige said.

“Even wen dem newly form di APC bifor di 2015 general election, plenty pipo bin decamp from di PDP to join dem, including some guvnors and even di Vice President Atiku Abubakar dat time. Shey Nigeria become one-party kontri? No. So e no be new tin.”

Di presidency too no agree wit many pipo ontop allegation say dem wan create one party state.

Special Adviser to di President on Information and Strategy, Bayo Onanuga insist say im principal, Bola Tinubu na democrat wey allow all parties exist at di same level.

“We don read di alarming claims of disgruntled opposition figures, some partisan human rights crusaders and emergency defenders of democracy over recent defections of key members of opposition parties into di governing All Progressives Congress,” e tok for statement.

E add say “We must add say no policy, official action, or directive from di presidency seek to ‘dismantle democracy’ or ‘weaken opposition or create a one-party state.

“Accusations of bribery, blackmail, and di weaponisation of state institutions only exist in di idle mind of politicians and dia agents wey don fail in dia role as opposition.”

Onanuga statement conclude say opposition political parties for Nigeria don fail to do dia work.

Wetin e mean for di pipo?

Even if analysts no fit tok for a fact say Nigeria fit dey head to a one party system, e clear say di political manoeuvring no necessarily dey in di interest of di pipo.

“Di job of di opposition na to always keep di ruling party on dia toes, and wen di opposition dey weak or no dey at all, di pipo in goment go dey do wetin dem like and e dey put di masses in a difficult situation, Oga Ige tok.

“If we go into election di way tins dey now, wit a very strong ruling party and very weak opposition, plenty pipo go dey disenchanted and dem no go wan come out to vote, and di pipo wey even go out to vote no go get any wahala wit selling dia votes, afta all, dem go say na still di ruling party go still win las las.”

Di only way to cure di argument of di issue of one-party system for Nigeria na for us to get stronger opposition political parties, Oga Ige add.

“Until we dey able to do dat, we go continue to dey struggle wit di disappointment wey many Nigerians dey suffer for di hands of dia elected leaders,” e tok.

And with PDP and Labour Party inside serious political divisions, eye don dey on di coalition wey politicians dey try to form.

Weda di coalition, or single opposition parties fit do anything to remove di ruling APC from power na anoda hard question.

Latest news
Related news