Explosion of drone for sky over di city during one Russian drone strike on 24 April
Russia President Vladimir Putin don announce temporary ceasefire for di war wey dem dey do for Ukraine.
Kremlin say dis ceasefire go occur from morning of 8 May until 11 May – wey be di same days wey Russia go do victory celebrations to mark di end of World War Two.
In response, Ukraine Foreign Minister Andrii Sybiha say dem want immediate ceasefire wey go last for “at least 30 days”.
While US President Donald Trump, wey dey try negotiate peace between di two sides, say im na permanent ceasefire im wan see, White House say.
Kremlin bin also announce similar ceasefire, 30-hour truce for Easter, but as di two side bin report say di fighting reduce, dem also accuse each other of hundreds of violations.
E don pass more dan 20 times wey dem don attempt ceasefire for Ukraine – all of dem bin eventually fail, some sef fail just few minutes afta dem declare am.
Di most recent one, na di one wey dem do for Easter, e bin dey very short and di only result wey e bin get na just small reduction for di fighting, as di two sides bin accuse each oda of not honouring di ceasefire.
Ukraine President Volodymyr Zelensky bin say Russia troops break di ceasefire nearly 3,000 times since di start of Sunday.
At di same time, Russia defence ministry bin say e “repel” assaults from Ukraine, come accuse Kyiv of launching hundreds of drones and shells. BBC bin no fit independently verify dis claims.
For one statement on Monday, Kremlin say Oga Putin declare di ceasefire “based on humanitarian considerations”.
Translation of di statement say: “Russia believe say di Ukraine side supppose follow dis example.
“In di event of violations of di ceasefire by di Ukraine side, di Armed Forces of di Russia Federation go give adequate and effective response.
“Di Russian side dey once again declare say e ready for peace toks without preconditions, wey im aim na to eliminate di root causes of di Ukraine crisis, and constructive interaction wit international partners.”
Afta dis release, Ukraine Foreign Minister Sybiha say: “If Russia truly want peace, e must cease fire immediately.”
“Why wait until May 8?” im write for X. “If dem fit cease di fire now and since any date for 30 days—so e go dey real, not just for parade.”
Im say Ukraine ready to support “lasting, durable, and full ceasefire. And dis na wetin we dey constantly proposing, for at least 30 days”.
White House press secretary Karoline Leavitt say Trump don dey dey “frustrated wit leaders of di two kontris”.
“Im wan see permanent ceasefire.
“I understand Vladimir Putin dis morning offer temporary ceasefire. Di president don make am clear say na permanent ceasefire im wan see first to stop di killing, stop di bloodshed.”
Dis latest announcement dey come during wetin US describe as “very critical week” for Russia-Ukraine peace toks.
Washington don dey try strike peace deal between di two sides, but Donald Trump administration don threaten to comot hand if dem no see progress.
Russia launch full-scale invasion of Ukraine on 24 February 2022, and currently e dey control about 20% Ukraine territory, including Crimea peninsula wey Moscow bin takeover for 2014.
Di estimate be say na hundreds of thousands of pipo – majority of dem soldiers – na im dem don kill or wunjure on all sides since 2022.