Rescue workers dey search di rubble for survivors
At least 98 pipo don die and more dan 150 bin wunjure as roof collapse for one nightclub for Dominican Republic capital Santo Damingo, officials tok.
One state govnor and former Major League Baseball pitcher, Octavio Dotel, dey among di pipo wey die.
Dotel wey be 51 years old, die for road as dem dey carry am go hospital afta dem pull am from under di rubble.
Di kasala happun early Tuesday morning during one concert wey popular merengue singer Rubby Pérez dey perform for Jet Set nightclub. Rubby Pérez self dey among di pipo wey die, im manager tok.
Hundreds of pipo bin dey inside di place wey di wahala happun and 400 rescuers dey still dey search for pipo wey survive.
Fear also dey say di number of pipo wey die fit increase.
Di director of Emergency Operations Centre (COE), Juan Manuel Méndez, tok say im still get hope say many of di pipo wey dey under di collapsed roof still dey alive.
Jet Set na one popular nightclub for Santo Domingo wey dey always host dance music concert evri Monday night. Politicians, athletes and oda important pipo bin dey dia wen di wahala happun.
Di govnor of Monte Cristi Nelsy Cruz also dey among di victims, President Luis Abinader tok. She be sister of di former baseball player Nelson Cruze wey be di Major League Baseball All-Star.
Dotel start im baseball career wit New York Mets for 1999, and later play for teams like Houston Astros, Oakland A’s, New York Yankees, Chicago White Sox and Detroit Tigers until 2013.
One video wey dem say dem record inside di club show pipo wey dey sddon for table near di stage, while some oda pipo dey dance for back as Rubby Pérez dey sing.
For oda phone recording wey dem share for social media, one man wey dey stand for di next stage bin tok say “sometin don fall from di ceiling”, and e use im finger dey point near di roof.
Inside di footage di singer Rubby Pérez, look like say e dey look wia di man dey point.
Less dan 30 seconds later, one loud noise burst and di video just go black. Na so one woman begin shout, “Papa, wetin happun to you?”
One of Rubby Pérez band members tell local media say di club full well wen di building collapse “around 1am.”
“I tink say na earthquake,” di musician tok.
Rubby Pérez daughter tok say her papa dey among di pipo wey bin trap inside di scrap.
President Abinader don express im condolences to di families wey di kasala affect.
People cry and hug each oda near di Jet Set nightclub in Santo Domingo