8.8 C
London
Thursday, April 24, 2025

Sabi pipo no agree say dire wolf don come back from extinction

Two of di wolves wey dey one month old Two of di wolves wey dey one month old

One ogbonge snow white wolf bin dey on top di cover of Time Magazine today togeda wit headline wey announce say di dire wolf don come back.

Di dire wolf wey now dey extinct get serious popularity afta e show for di Game of Thrones. But na real animal wey bin exist ova 10,000 years ago and dey waka across di Americas.

One company wey dem dey call Colossal Bioscience na dem cause di headlines as dem say dem use “deft genetic engineering and olden days DNS” take breed three dire wolf to take “de-extinct” di species.

But even though di young wolves wey dem name Romulus, Remus and Khaleesi na proof of ogbonge technological breakthrough, independent sabi pipo tok say no be dire wolves dem be.

Zoologist Philip Seddon from di University of Otago for New Zealand explain say di animals na “genetically modified grey wolves”.

Colossal reveal dia efforts come outside say dem dey use cutting edge genetic techniques to take bring back extinct animals like di woollt mammoth and di Tasmanian tiger.

But sabi pipo don torchlight important biological differneces between di wolf for di cover of di Time and di dire wolf wey bin fry roam and hunt for di last ice age.

Paleogeneticist Dr Nic Rawlence, we also be from Otago University, explain how di ancient dire wolf DNA wey dem comot from fossil remains bin dey too degraded and damaged to fir biologically copy or clone.

Dr Rawlence tell BBC News say, “ancient DNA be like if you put fresh DNA for inside 500 degree oven overnight. E go comot fragmented like shards and dust. You fit reconstruct am but e no go dey good enough to do any oda tin wit.”

E add say instead di de-extinction team use new synthetic biology technology wey snip pieces of DNA and insert dem to genetic code of living animal wey still get dia full bological blueprint in tact, in dis case dem use grey wolf.

Dr Rawlence say, “so wetin Colossal don produce na grey wolf, but e get some dire wolf like characteristics like bigger skull and white fur. Na hybrid.”

Dr Beth Shapiro, wey be biologist from Colossal Biosciences say dis work represent de-extinction wey she tok say mea recreating animals wit di same characteristics.

“Grey wolf na di closest living relative of dire wolf, genetically dem dey very similar so we target DNA sequences wey lead to dire wolf traits and den edit grey wolf cells… den we clone those cells and create our dire wolves.”

According ot Dr Rawlence sha, dire wolves comot from grey wolves anywia between 2.5 to six million years ago.

E ok say, “na completely different genus to grey wolves. Colossal compare di genomes of di dire wolf and di grey wolf and from about 19,000 genes, dem determine say di 20 changes for 14 genes give dem dire wolf.”

Di edited embryos bin dey implanted inside surrogate domestic dog mamas.

According to di article for di Time, all three wolves bin dey born wit planned C-section to fit minimise risk of complication.

Colossal wey bin dey valued at $10bn for January dey keep di wolves for private 2,000-acre facility for one undisclosed location for northern US.

Las-las sha, di pups resemble weti many pipo dey tink of wen dem tok about dire-wolf and di tori don gada global attention. So wetin come make dis scientific distinction to dey important?

Dr Rawlence tell BBC News say “na bicos extiction still be forever. If we no get extinction how we go take learn from our mistakes?

“Di message now don turn sat we fit destroy di environment, and say animals fit go extinct but we go fit bring dem back?”

Latest news
Related news