Vice President Naana Jane Opoku-Agyemang
Di office of di president for Ghana don confam say di Vice president don sick.
Na so she travel abroad for medical care.
Inside one statement from di minister of goment communications, dem tok say “di VP Her Excellency Prof Naana Jane Opoku-Agyemang bin receive treatment for di university of Ghana medical center on Saturday afta she get sudden illness.”
Di statement say “di sickness of di VP happun afta work on Friday 28 March.”
“Based on wetin di medical pipo don tok, im go go abroad for further care,” di goment tok tok pesin oga Felix Kwakye Ofosu don tok.
Profession Naana Opoku-Agyemang togeda wit di President John Mahama on Friday bin host Iftar for di goment house.
Dem join oda Muslims to break dia fast dat day, wia di VP don go around to dey share fruits and oda tins for di place.
Professor Opoku-Agyemang tok say “as we bin dey observe dis period of prayer and sacrifice, make pipo uphold di values of love and compassion and service to humanity.”
Also dat Friday, di Vice president na special guest for di university of Ghana as dem do inaugural lecture for di first full female professor of physics – professor Nana Ama Browne Klutse.
Profile of Naana Jane Opoku-Agyemang
Dem born Naana Jane Opoku-Agyemang on 22 November 1951.
She come from Cape Coast in Ghana. She don earn many prestigious academic degrees and awards.
She earn her Bachelor and Diploma in Education from di University of Cape Coast, Master and Ph.D. in English Literature from York University in Canada.
She dey among di executive board of di United Nations Educational, Scientific and Cultural Organization (UNESCO) and di editorial board of Harriet Tubman Series on di African Diaspora (Africa World Press Inc. USA).
Prof Opoku-Agyemang get many publications on women in literature, oral literature in Africa and she be member of di Ghana Academy of Arts and Sciences and Fellow of di Commonwealth of Learning.
Prof Opoku-Agyemang wey marry 40 years ago, get three pikin and two grandchildren from her pikin dem.
Her role in Ghana politics dey progressive for women wey dey di kontri as she dey ginger dem to pursue political leadership for Ghana.
She dey bring fresh perspective to national policies wey go advance di educational sector in Ghana.
During di period she serve as minister – she win di award for di best performing minister.