18.5 C
London
Saturday, May 10, 2025

Wetin we know about di tourist submarine wey sink and kill pipo for di Red Sea

At least six pipo don die, and nine odas injure afta one tourist submarine sink off di coast of di Egyptian Red Sea city of Hurghada for di early hours of Thursday, 27 March.

Moscow embassy for Egypt for one statement on dia Facebook page tok say, about 45 passengers bin dey on board di submarine, including children, and dem believe say all of dem be Russian.

Local authorities for Hurghada tok say dem rescue 29 pipo afta di incident happun and dem don carry dem go nearby hospital, four of dem condition dey critical.

Di incident happun around 10:00 local time, around 0.6m (1km) from di shore, di statement tok.

Di submarine wey di name na Sindbad, bin sink close to di harbour for Hurghada, one popular tourist resort for di Red Sea, wey dey known for dia beaches and coral reefs.

Di reason behind dis latest tragedy neva dey clear yet. However, di Red Sea govnor Amr Hanafy tok say authorities dey investigate di cause.

Oga Hanafy add say no tourists dey missing, for one update on im Facebook.

Where di submarine sink

Di tourist submarine bin sink off di Egyptian Red Sea city of Hurghada early on Thursday, di BBC understand.

E sink close to di harbour.

Di city na popular tourist destination wey dey known for dia beaches and coral reefs.

Wetin we know about Sindbad – Di submarine wey sink

One foto on di Sindbad Submarines website – BBC no fit confam if dis na di exact type of boat wey involve for di incident

Sindbad don dey operate tourist trips for di Hurghada area for several years.

Di company tok say dem get only two out of di “14 real recreational submarines” for di world.

Di company dey allow tourists travel 25 metres (82 feet) deep for inside di sea to explore “500 metres of coral reef and dia marine inhabitant”.

For di website for Sindbad Submarines, dem write say: “Dem dey offer 44 passenger seats – two pilots’ seats and one sizable round viewing window for each passenger.”

Egypt Red Sea coast get history of tourist boat accidents

Dis no be di first-time tourist boats go sink for Hurghada.

For November 2024, one tourist boat wey di name na Sea Story bin sink, leaving 11 dead or missing – including one British couple, and 35 pipo survive.

At di time, Egyptian authorities bin tok say na one huge wave wey dey up to 4m (13ft) cause di incident – but BBC follow some survivors tok and dem say, safety issues dey.

For February, UK investigators tok say 16 incidents wey involve “liveaboard” vessels don happun for di area in di last five years, wey lead to deaths.

Latest news
Related news