18.8 C
London
Wednesday, May 14, 2025

South Sudan VP Machar under house arrest, im party tok

Dem bin arrest Machar im senior allies early dis month Dem bin arrest Machar im senior allies early dis month

Dem don put South Sudan dia first vice president Reik Machar wey be long-time rival of di kontri president Salva Kiir, under house arrest, im party tok.

Sudan People’s Liberation Movement for Opposition (SPLM/IO) tok say one armed convoy wia ogbonge security officials lead – wey include di defence minister, enta Machar house for di capital Juba, wia dem collect di arms for di hands of im bodyguards on Wednesday.

“Technically, Dr Machar dey for house arrest, but di security pipo bin try to carry am go,” Reath Muoch Tang wey be chairman of di party foreign relations committee tok.

Di goment neva comment for dis mata.

Di UN bin dey warn say South Sudan don dey enta anoda civil war afta di kasala between Machar and di president don dey boil dey come for weeks.

Di two leaders bin agree for August 2018 to end a five-year civil war wey kill nearly 400,000 pipo.

But ova di last seven years, dia relationship don spoil as ethnic tension and violence don dey rise.

Di SPLM/IO tok say dem detain Machar togeda wit im wife Angelina Teny, wey also bi di interior minister for di kontri.

“Dem bin present one arrest warrant to am, wey di charges no clear,” Tang explain inside one statement, wia im describe di action as “violation of di constitution and revitalized peace agreement.”

“Di arrest of di first vice-president without due process don dey undermine di rule of law wey im dey threaten di stability of di kontri,” im add.

Di UN mission for South Sudan don warn say di kontri dey risk di “progress wey dem bin dey get ova di past seven years” if war start again, afta tori of Machar im detention don comot.

“Tonight, di kontris leaders bin dey stand on edge of anoda widespread conflict,” di mission tok for one statement on Wednesday.

To dey violate di 2018 peace deal “go mean say South Sudan go scatter again wey e go affect di entire region,” dem add.

Di British and di US embassies for di kontri reduce dia diplomatic staff wey dem tell dia citizens to comot di kontri – while di Norway and German embassies don close down dia operations for Juba.

Di tensions don dey rise between forces wey dey loyal to di two rivals for di northern town of Nasir for di oil-rich Upper Nile state

Latest news
Related news