File photo dsecribing the story
Di families of Onuche dey mourn di death of dia two daughters wey suspected ritualists brutally murder for Port Harcourt, Rivers state.
Di sisters Chizaram Onuche and Chidinma Onuche wey be seven-year-old na cousins. Dia fathers na brothers.
Barrister Linda Ojims wey speak on behalf of di family, tok say dem dey really devastated and dey demand for justice.
“Di families no dey happy, dem dey grieve, pipo full dia house dey cry. One of di brothers wife get belle and since she hear di news of her daughter death, she neva get hersef.” Barrister Ojims tell BBC Pidgin.
Di lawyer wey dey help police wit di investigation, tok say di children bin dey come back from church wen one of di suspects wey police don arrest, stop dem and carry dem go one uncompleted building.
Police arrest native doctors and oda suspects
Rivers State Police Command say dem don arrest four suspects in connection wit di ritual killing.
Tok-tok pesin of di police, Grace Iringe-Koko for statement on Wednesday, 26 March tok say dem arrest one native doctor, one teenage girl and two odas on top accuse say dem get hand for di crime.
Dem drug and kill di girls for Ogbodo Pipeline area of Rukpokwu for Obio-Akpor Local Government Area, police tok.
According to di police, Uko allegedly lure di victims to im location, drug dem wit one drink wey di name na Black Bullet, kill dem and collect dia blood for bottle.
During di operation, di law enforcement officers tok say dem recover key evidence wey include;
. One bottle wey contain di blood of di victims
.Kitchen knife wey dem identify as di murder weapon
.Empty can of black bullet dem use drug di victims bifor di act
.Spoon wey dem use collect di victims blood
. Di Commissioner of Police, CP Olugbenga Adepoju tok say investigation dey go on to uncover further details and possible accomplices.
E say justice go prevail and those wey get hand for di crime go face di full extent of di law.
Cases of ritual killings don dey on di rise for Nigeria.
Figures wey di National Bureau of Statistics (NBS) recently release show dem record ova 150 ritual killing cases, wey dem often link to young people wey dey find quick wealth, in di past six months.
One of di most recent ritual killing cases na one wey involved one famous Islamic cleric, wey allegedly murder one final-year student of di Kwara State College of Education, Ilorin, Hafsoh Lawal.
According to di Kwara State Police Command, di 29-year-old suspect bin kill Ms Lawal and cut-cut her body for alleged ritual purposes for Ilorin on 11, February.
Also, for January, di Rivers State Police Command bin arrest two pastors, afta dem discover fetish items – wey include caskets, monkey skulls, carved skeletons, and oda ritual materials—inside dia churches.
For 2022, members of di House of Representatives bin ask di Nigeria goment to declare a state of emergency on di rising cases of ritual killings for di kontri.