Tuface Idibia and Annie Idibia
Shock, disbelief, sadness, relief, na how some fans, celebrities and concerned pesins take react afta Nigeria famous music icon, Innocent Idibia announce separation from im wife, Annie Idibia.
On Sunday, 26 January, di music star wey pipo sabi well-well as Tuface reveal say im and im wife of ova 10 years don separate for sometimes now and dem dey wait for divorce.
E announce di informate for inside one post e share on im Instagram account.
“Well dis thing wey I wan tok dey short but also long. I and Annie Macaulay don separate for a while now. And currently filed divorce.”
For di post, di 49-year-old singer promise to release a statement soon to share im side of di tori. E add say while im personal life dey private, e feel say e dey necessary to provide clarity out of love for im supporters.
“Hello to my beautiful pipo of all federations. Well, dis thing I wan tok dey short but also long. Annie Macaulay and I don dey separated for a while and don file for divorce.
“I go grant press release soon to say my story—no be becos na anyone right to know about my personal life, but becos I love my pipo, and I need dem to know my innocence or offence. Stay blessed, my pipo. I love you all,” di singer add for di now deleted post.
Drama afta viral separation post
Di post wey announce di separation and probably divorce of these love birds wey dia grand wedding for 2013 shake di kontri, bin shock some of dia fans, while odas say, di separation dey long overdue.
However, within minutes afta di post go viral, Tuface for anoda post on im Instagram page claim say im account dey hacked and dem dey try to get am back.
“My Instagram don dey hacked; wey dey put effort to try take back control. #One Love.”
As fans dey rejoice and deliberate on di authenticity of di post, Tuface for anoda video, almost immediately post again for im Instagram account say nobody hack im account.
“Hey, my pipo nobody hack my account; I tok wetin I tok. I come in peace.”
As at Monday, 27 January morning, BBC Pidgin check say e don delete most of di post on im Instagram account, wey include fotos of im and im wife.
Social media divide ova Tuface marriage separation
Annie wey don dey for spotlight recently, afta her appearance on di latest season of “Young, Famous and African,” where she open up on issues for her life, especially on di miscarriage she get last year wey lead to di loss of twins neva react to di news of di separation.
However, separation of di lovebirds don turn hot gist for street and for social media. Dis na as celebrities and fans don begin take sides and apportion blame.
While some hope say make di two go make up and get back togeda, odas believe say dis fit be di right thing for di couple wey don weather many storms togeda.
Di long road of love
2Baba as pipo often dey call am and Annie relationship start for sometimes around 1999 as friendship wey later turn into love.
Annie enta public eye wen she appear for Tuface popular song “African Queen” music video for 2004. Dem welcome dia first daughter, Isabella, for 2008.
For 2012, 2Baba propose to Annie on Valentine’s Day and dem do one private wedding di same year. Dia grand white wedding wey be tok of town bin follow for Dubai on 23 March 2013, and dem welcome dia second daughter, Olivia, for 2014.
Dia relationship and marriage face plenty challenges, particularly sake of 2Baba past relationship wit Pero Adeniyi, di mother of three of im children. E also get two children wit anoda woman, Sumbo Adeoye.
Despite tensions and public controversies, di couple bin renew dia vows for 2022 for dia 10th wedding anniversary. Dem reaffirm dia love and commitment to di marriage.
Tuface and Annie na one of Nigeria most admired celebrity couples.
Who be Innocent Idibia?
- Di controversy of di divorce of Ghanaian actress Fella Makafui and Medikal
- 2025 Oscar Nominations: ‘Emilia Pérez’ and ‘The Brutalist’ Get Multiple nomination
- Baftas 2025 full nominations list