Foto collage of di late Salome Adaidu and Timileyin Ajayi
Di High Court of Justice for Lafia, Nasarawa state don adjourn di trial of di suspected killer of di late Salome Adaidu to 17 – 20 March, 2025.
Di alleged killer of di late Salome Adaidu, Timileyin Ajayi, plead not guilty to di one count charge of culpable homicide wey dey punishable by death, contrary to Section 221 of di Penal Code of Northern Nigeria.
Timileyin Ajayi show face for di High Court of Justice, Lafia, di Nasarawa State capital wia dem arraign am on Monday 27 January, 2025.
Na Justice Simon Aboki sitdown ontop di case for di arraignment.
Channels report say di prosecuting counsel Stanley Nwaforagwu, afta di arraignment, tell tori pipo say “dem properly arraign di defendant, Timileyin Ajayi bifor di High Court of Justice, Lafia on a one-count charge of culpable homicide punishable wit death.
Dem take im plea and im plead not guilty to di charge and dem set di date for trial. Di case dey adjourned to 17 – 20th March for trial.”
“Di court want make di trial happun sharp-sharp and na a welcome development. We get overwhelming evidence to sustain di charge and we dey optimistic say dem go do justice.”
Di Defense Counsel, Joseph Tukur, say, “today na basically for arraignment and as di law demand, im don enta im plea already. So, we don take a date for hearing. No be my place to prove di case, na my place to defend am, di work of di defence counsel na to make sure say di prosecution do dia work legally well wey go prove di case beyond a reasonable doubt. I dey here to make sure say di law dey fulfilled.”
According to local media, one Senior Advocate of Nigeria Jibrin Okutekpa wey lead di team of lawyers for di family of the deceased, tok say, “We dey watch in brief for di family of di deceased. We no dey here for di defendant and dis na serious mata of national importance and we dey here to see say dem do justice.”
On 17 January 2025, Justice Aboki of di High Court for Lafia, Nasarawa State bin adjourn di hearing of di alleged murder of National Youth Service Corps member, Salome Adaidu to 27 January, 2025.
Timileyin Ajayi bin allegedly kill Salome Adaidu for early January.
Police bin arrest am with di head of one National Youth Service Corps member, Salome Adaidu as e dey go Uke for Nasarawa State.
Police also drag di 32-year-old gospel singer to court on a one-count charge of culpable homicide wey dey punishable by death.
Court come give order make Ajayi, stay for prison.
Justice Aboki give order make e stay for di correctional facility for Lafia sake of say im bin no fit take im plea becos im counsel (lawyer) bin no show face for court.
Ajayi allegedly murder Salome wen she bin visit im house for di Papalana axis for New Karshi for Karu Local Goment Area of Nasarawa State.
Police bin parade Ajayi wit di knife and machetes im allegedly use to commit di crime.