13.1 C
London
Thursday, June 5, 2025

Which foreign leaders no get invitation to Trump inauguration

All eyes dey on United States of America as di whole world dey wait for di inauguration of di 47th US president.

On im part, US President-elect Donald Trump break tradition unto who im invite and who im no invite come im inauguration – coronation style.

Both Trump and Vice President-elect JD Vance dey set to take oath of office and begin new administration inside one long day of celebrations wey go include musical performances and parade.

However, unlike traditional inaugurations of US presidents, dis one go include plenty foreign leaders, including Trump close supporters and even some of im rivals.

At least seven sitting heads of state and two former leaders na im dem invite. According to Reuters, about 500,000 guests dey expected in total.

Dis na breakdown of some of who dem invite and who dem no invite and why di guest list dey so different from wetin dey happun bifor:

Wetin different about dis inauguration?

President-elect Trump dey break wit US tradition for dis event.

Usually, presidential inaugurations na domestic affair: meaning say di president and vice president go take dia oath wit US officials, past heads of state and other American VIPs present on di steps of US Capitol building.

Dem dey allow di public to watch from di surrounding grounds.

However, for dis event, wey go get inaugural speech, parade, musical performances and balls, go also be international affair.

Tori be say na close to twelve world leaders na im dem invite.

Foreign leaders no dey usually attend US presidential inauguration; instead na diplomats like kontri ambassadors to di US, or foreign ministers, dey act as representatives.

Who dem no invite?

UK Prime Minister Keir Starmer no get invitation, im office confam on Thursday. However, dem invite di far-right politician, Nigel Farage of di Reform UK party, and im go dey present.

Trump completely ignore European Commission head Ursula von der Leyen, and most of European Union and members of NATO (North Atlantic Treaty Organisation).

Germany President Olaf Scholz, wey dey lead EU largest economy, dem shun am too.

Dem however send invitation to Alice Weidel, leader of di opposition party Alternative for Germany (AfD), wey her co-leader Tino Chrupalla go attend.

India Prime Minister Narendra Modi: Modi and Trump bin share “bromance” since di first Trump presidency.

Following im election victory for December, Modi bin dey among di first to call and congratulate Trump.

While di PM no go attend, Foreign Minister Subrahmanyam Jaishankar go represent am.

Santiago Abascal, wey dey lead di Spanish right-wing Vox Party, and Andre Ventura of Portugal majority Chega party, go dey dia.

French President Emmanuel Macron no get invitation, although Macron and Trump get friendly relations.

Instead, French far-right politician Eric Zemmour of di Reconquest party go dey present.

Who dem invite?

Several heads of state, popular leaders wey support Trump go show, but so too some of im rivals go also show. Dem include:

Argentina President Javier Milei: Milei don confam say im go attend.

Trump bin hail di leader one time as a man wey fit “make Argentina great again” and, for December, im welcome Milei for im Mar-a-Lago residence for Florida.

Chinese President Xi Jinping: Trump invite Xi to di ceremony for December, move wey im tok tok pesin say na signal of im readiness to interact wit im Chinese counterpart, even wit di trade war wey dey hang for air.

Xi no go attend, however, Vice President Han Zheng go show.

Italy Prime Minister Giorgia Meloni: Meloni, of di Brothers of Italy party, visit Mar-a-Lago for January. Her office say she fit to attend if her schedule permit.

Hungary Prime Minister Viktor Orban: Orban na close Trump supporter and im bin don say im believe di president-elect go end Russia war on Ukraine.

According to local media, im no go fit make am sake of one state address.

Ecuador President Daniel Noboa: Noboa bin hail Trump December victory as victory for Latin America, too.

Im office confam say im go pause im re-election campaign to travel go Washington for di inauguration.

El Salvador President Nayib Bukele: Bukele office never confam say im go attend yet.

Trump son, Donald Trump Jr, na friends wit Bukele, and for July 2024, im bin attend im inauguration for San Salvador.

Former Brazilian president Jair Bolsonaro: politician wey dem nickname di “Trump of di Tropics” bin also get invitation, but im no go attend sake of im ban from travelling.

Im kontri Supreme Court seize im passport as im dey face several investigations, including alleged attempt to turn di results of di 2022 general election, wey im lost.

Former Polish Prime Minister Mateusz Morawieck, wey recently become leader of di European Conservatives and Reformists party for EU parliament, go also attend.

Latest news
Related news