4.5 C
London
Thursday, November 12, 2026

Ghana parliament tighten security ahead of ‘showdown’ sitting over suspension of four Lawmakers

General view of di Parliament of Ghana during Turkish President Recep Tayyip Erdogan visit, for di capital Accra on March 01, 2016.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, General view of di Parliament of Ghana during Turkish President Recep Tayyip Erdogan visit, for di capital Accra on March 01, 2016.

Di Parliament of Ghana don tighten security ahead of lawmakers begin arrive for major sitting for di chambers.

Already lawmakers wey dem bin declare dia seats vacant don reach di chamber to take position.

Dis dey come afta speaker of Parliament, Alban Sumana Kingsford Bagbin, on 17 October declare four parliamentary seats vacant.

Oga Bagbin declaration na based on say di current occupants don defect as dem file to contest di next elections on tickets wey dey different from di party wey bring dem come di Parliament.

On Friday 18 October, di Supreme court temporarily stop di speaker decision to declare di seats of four seats vacant.

Di court order for suspension of enforcement of Oga Bagbin ruling of 17 October, to allow di MPs to retain dia positions for time being.

Meanwhile for one press statement wey one Deputy Marshall of Parliament Frederick Bawa sign, explain say di measures aim na to fit guarantee di safety and security of di Speaker of Parliament, Alban Suman Bagbin, MPs, and staff.

Who be di law makers wey dey affected?

Di four MPs bin file to contest di the next parliamentary election as independent candidates.

Cynthia Mamle Morrison na di MP for Agona West, under di New Patriotic Party (NPP).

Kwadjo Asante for Suhum for Ghana Eastern Region also be MP under di New Patriotic Party (NPP) bifor im declare to run as independent candidate during di next election.

Peter Kwakye-Ackah na MP for Amenfi Central, for di National Democratic Congress (NDC).

Andrew Amoako Asiamah na MP for Fomena, e also be di Second Deputy Speaker, bifor dey elected as independent candidate but now don file to contest di next election on di ticket of di New Patriotic Party (NPP).

- Advertisement -
Latest news
Related news