
Voting for di Ghana election don officially end, and wetin pipo dey wait for next na di announcement of results.
Di Electoral Commission of Ghana na di only body wey fit make official announcements as di results begin enta from different polling units.
According to di Electoral Commission, di procees of announcing di results na say di collation of di results for di presidential election go start from all di polling stations.
Dem go collect di results sheets from di polling stations come send dem to di constituency collation centre, wia dem go declare di constituency results.
From dia, dem go post am to di regional collation centre, wia all di results from all di constituencies for a particular region dey and dem go also declare di winner for di region.
From di region, dem go post di results to di Electoral Commission head office wia political party representatives dey, observers dey, tori pipo dey too sake of say dem wan chook eye for di process.
Na afta all dis process di Chairman of di Electoral Commission of Ghana go put all dis results togeda to announce di winner.
Di voting wey bin start by 7:00 am on Saturday morning close around 5:00pm Ghana time.
E dey expected say di electoral commission go announce di results afta 72 hours (about 3 days) from wen di polls close.