Pidgin English: Jordan Ayew skata South Korea


Jordan Ayew score three goal join de one wey Asamoah Gyan score on Monday, as Ghana waya South Korea 4-kondo for dia las World Cup prepia match.

Ayew fes score as match reach 11 minit, bifor hin tia net again for 53 minit and 89 minit to score wetin oyibo dey call ‘Hat-trick.’ (e mean say hin score three goal)

Forma Sunderland strika, Asamoah Gyan, bin dey siddon for bench since Ghana start dia World Cup prepia match, but hin join 10 oda playas wey coachi carri start dis match, come score goal for 44 minit.

Ghana go start dia World Cup gbege for Group G, for June 16, wen dem go follow USA play. Ghana bin don waya USA for World Cup, two tines bifor. Dem bilala dem for las 16 for 2010 World Cup for South Africa, afta dem bin bilala dem for Group match for 2006, for Germany World Cup.

Ghana go still follow Portugal and Germany play for Group G sef.

South Korea go try forget dis bilala wey Ghana give dem so, as dem go follow Russia play fes match for Group H, for June 17. Algeria and Belgium dey inside did group sef.

Source: www.supersport.com

For more Ghana football news visit www.ghanasoccernet.com

Comments:
This article has 0 comment, leave your comment.